Iran name Khamenei son Mojtaba as new supreme leader

Man hold foto of Mojtaba Khamenei

Wia dis foto come from, EPA

Read am in 2 mins

Iran don name Mojtaba Khamenei to succeed im papa Ali Khamenei as Supreme Leader.

Dis one show say di hardliners remain fully in charge for Tehran one week into dia fight-fight ‌with di United States and Israel.

Mojtaba, wey mid-ranking cleric wit plenty influence inside Iran security forces and wide business networks under im father, don dey as di favourite ahead of di vote by di assembly, a body of 88 clerics wey dia work na to choose di new leader afta Ali Khamenei.

Over di past week, and again on Sunday, US President Donald Trump say e go like play role in di selection of di new Iranian supreme leader.

Whil e show sign say e go prefer pesin wey get link wit di old leadership make e take over, e make am clear say im no like Mojtaba Khamenei – wey dem just confam as im papa successor.

"Khamenei son dey unacceptable to me," Trump tok earlier dis week. And only a few hours ago, etok say, without I, approval, whoever take over "no go last long".

Israel issue warning before dem name Khamenei second as di new supreme leader - saying dem go "kontinue to pursue evri successor" to di late ayatollah.

Who be Mojtaba Khamenei?

Dem born am on 8 September 1969 in di northeastern city of Mashhad, and na im be di second of Khamenei six pikin.

E finish secondary school education for Alavi School for Tehran.

At age 17, Mojtaba serve for military for short period during di Iran-Iraq War, according to Iranian media.

Di eight years bloody conflict make di regime dey suspicious of di US and di West, wey support Iraq.

For 1999, Mojtaba go Qom, wey be holy city and wey dey important for Shia theology, to continue im religious studies. E dey notable say e no wear clerical clothes until dis time, and e dey unclear why e decide to attend seminary at 30, as e dey common to go wen you dey younger.