Saudi Sleeping Prince die afta 20 years in coma

Wia dis foto come from, Social Media
Di Saudi Royal Court don announce di death of Prince Alwaleed bin Khalid bin Talal, wey pipo sabi well-well as di "Sleeping Prince," on Saturday, 19 July.
E die for di age of 35, afta e dey for coma for 20 years.
Prince Khalid bin Talal father mourn di death of im late son for one statement on X.
"O reassured soul, return to your Lord, well-pleased and pleasing [to Him], and enta among My servants and enta My Paradise... Wit hearts wey believe in God will and destiny, and with great sadness and sorrow, we mourn our dear son, Prince Alwaleed bin Khalid bin Talal bin Abdulaziz Al Saud, may God have mercy on him, wey pass away to God mercy today."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, SOCIAL MEDIA
Dem born di late Prince Alwaleed bin Khalid for 1990.
E bin dey involved for inside one traffic accident for 2005 wen e be student for di Military College, e suffer brain haemorrhage wey leave am for coma for more dan 20 years.
Throughout these years, e remain under medical care, and e capture public opinion for Saudi Arabia as a humanitarian and rare medical case.
Everyone follow for im every movement wen e dey for coma.
For 2019, tori spread say im head and left arm dey move, according to im family. However, e no ever fully recover.
Fake tori say e wake from coma spread earlier dis year, but di Saudi royal family deny di reports until dem officially announce im death.
Ova di years afta im injury, tori of di "Sleeping Prince" bin gain widespread attention across Saudi Arabia and di Arab world sake of im unique medical condition and humanitarian stance, particularly given di determination of im family and im papa to complete im treatment.










