Dem prevent am for di second time from Rwanda presidential race - Who be Diane Rwigara?

Rwigara dey very outspoken

Wia dis foto come from, AFP

One ogbonge outspoken woman Diane Rwigara wey dey always tackle di incumbent President of Rwanda no got fit take part for di presidential race.

Di electoral bodi no clear Ms Rwigara wey be critic of President Paul Kagame.

Wit dis, di electoral bodi for Rwanda don comot her name from di list of pipo wey dey contest to be president for di kontri next month.

Na only Mr Kagame and two oda politicians go dey eligible to contest for di presidential seat of Rwanda.

Frank Habineza of di Democratic Green Party and Philippe Mpayimana, one independent candidate follow for di three pipo wey dey cleared to contest as president for di kontri, according to di electoral bodi.

Who be Daine Rwigara?

Ms Rwigara, don post for her X page to tok how disappointed she dey sake of her disqualification.

For 2017, dem also disqualify Ms Rwigara from contesting for election.

“Why you no go let me run? Dis na di second time wey you don cheat me of my my right to campaign,” she say.

Ms Rwigara na 42-year-old political woman wey be di leader of di People Salvation Movement (PSM).

She tell BBC Newsday programme say she dey hope to be able to stand dis time around—but dem disqualify her.

"I represent di vast majority of Rwandans wey dey live in fear and dem no dey allowed to be free for dia own kontri,” she tok.

Why dem disqualify Daine Rwigara

Wen di electoral commission bin release di provisional list of candidates, dem say Ms Rwigara bin fail to provide di correct document wey show say she no get criminal record.

Di electoral bodi also add say she bin fail to show say she get enough support nationwide wey fit make her stand to contest.

"On di requirement for 600 signature endorsements, she no provide at least 12 signatures from eight districts," Oda Gasinzigwa, di electoral commission chief tok.

Anoda reason wey di commission give be say Ms Rwigara bin fail to prove say she be Rwandan by birth.

She don hold citizenship of Belgium bifor but she surrender for 2017 bifor she bin contest to become a candidate—di last time.

But Ms Rwigara bin tell BBC say na Rwanda dem born her and she reject all di excuses wey di electoral bodi give to disqualify her from contesting as president.

Na a total of nine applications to stand for president di Rwanda National Electoral Commission bin receive.

Dem go release dia final list next Friday as dem still dey receive appeal—but PSM leader Ms Rwigara no go fit appeal at as e don dey too late.

Wetin happun bifor?

For 2017 dem prevent her from contesting. Dem give reason say she forge di signatures of supporters for her application.

Dem send Ms Rwigara go prison for more dan one year for forgery but dem let her go for 2018.

She tok say di charges dey politically motivated by her opponents.

Anoda reason she bin go prison na sake of allegations of threatening state security and say she misyarn ova di 1994 genocide wey happun for Rwanda.

For Rwanda, pipo wey don go jail for more dan six months no go fit contest for elections.

Di two candidates - Mr Habineza and Mr Mpayimana wey Rwanda electoral bodi bin clear na di only candidates wey also contest against Kagame for 2017 election.

Kagame dey run for di fourth term and if e win, e fit extend im presidency to ova three decades (30 years).