Who dey win election for Nigeria, personality or party - Adeleke go fit win under Accord Party?

Wia dis foto come from, Govnor Ademola Adeleke X/Peter Obi X
Rivers State Govnor Siminalayi Fubara and Osun State Govnor Ademola Adeleke announce dia defections from di opposition Peoples Democratic Party, PDP on Tuesday.
Di govnors dia defection na di latest in di wave of defections wey di PDP dey record.
As wit most of di recent defections wey we see, Govnor Fubara defect to di ruling All Progressives Congress, APC.
But na di defection of Govnor Adeleke to Accord Party na im really stand out because e defect to a relatively 'small party'.
Di Osun State Govnor, announce im defection on Tuesday afta e bin earlier resign from di PDP.
"I join di Accord Party more dan one month ago, precisely on November 6, as a platform to seek re-election in 2026." Govnor Adeleke tok.
Adeleke move don bring up di question if e go fit win re-election under di Accord Party wey no dey popular like di big names for 2026.
Who dey win election for Nigeria - Personality or Party?
E don pass 25 years of democratic rule for Nigeria and history don show say na only few times wey anoda political party don win state election for Nigeria outside di ruling party.
Wen democratic rule return to Nigeria for 1999 di ruling party dat time na di Peoples Democratic Party (PDP).
Dem bin dominate most of di states for Nigeria apart from Lagos, but as time dey go, tins begin change small-small as more political parties begin gain ground.
Political parties begin collabo so dat dem go get more strength, get more pipo and win more seats for elections.
Now, Nigeria get parties like Accord, Action Democratic Congress (ADC) Labour Party and some odas wey still dey try to balance well.
In all dis, na di ruling APC get strength pass for now.
For di 2023 Presidential election, Peter Obi na one of di candidate wey pipo like im personality.
E make Labour Party wey bin no too get grounds to get plenti pipo wey wan vote for Obi sake of im personality.
Peter Obi as presidential candidate bin change pipo mindset, especially young pipo wey even come out to vote sake of am.
Pipo also like di way di former Anambra State govnor bin dey live im life, pipo see am as simple man wey fit manage di economy of Nigeria sake of how e bin manage Anambra State as govnor.
Dem even like im pesin sake of how e dey criticise some govment policies, dey even drag politician.
Although e win Lagos State, e come third for di general election.
Wit all dis good tins pipo bin like about Peter Obi , e no still win di presidential election. Obi like odas loose.
So wetin dey help pipo win election for Nigeria, personality of di individual or political party?
Political analyst Bala Mohammed try to ansa dis question. For interview wit BBC Pidgin im tok say "both personality and party dey help pesin win election for Nigeria"
Im tok say di two dey play different and important roles, while pesin fit like pesin personality, im character and how im dey behave, im still need political structure and beta platform to contest under as di Nigeria constitution neva sabi Independent candidacy.
"Pipo fit choose to vote for pesin sake of im intellectual capacity, relationship wit pipo, di pesin personal achievement and oda tins but political party also get dia influence on pipo wey dey vote and wia dem get majority, thirdly na wen di political party and di individual dey deliver."
Im conclude say di two need to work togeda for a successful election to hapun.
Govnor Adeleke fit win re-election under Accord Party?
As Osun State Govnor don port go Accord Party wey dey relatively smaller dan di oda opposition parties, im fit win re-election?
Political analyst Bala Mohammed say for di case of Adeleke, im believe say im fit win re-election even though Accord Party no be ruling party and dem name no too strong like dat.
Im add say na di work wey Govnor Adeleke don do bifor na im go help am win re-election.
"E depend on wetin Adeleke bin don put on ground, wetin im bin don achieve in terms of in infrastructural development, healthcare and education."
Im explain say if di pipo of Osun State like wetin im do for dem, weda im party small or not e no really mata.
Im add say make pipo try dey shift from political party and personality and vote dia conscience.
According to am, Nigeria don old pass all dis tins and we dey for di political era for di world wey na ideologies dey win election.
Some political parties wey remove ruling parties for dia state election
For 2003 Anambra State election - Former Govnor Peter Obi remove PDP wey bin win di election afta Supreme declare say PDP bin use mago-mago win am.
Dat time Peter Obi bin contest under di All Progressive Grand Alliance, (APGA) na so im take remove di PDP wey bin dey rule for di state.
For 2023 Abia State election - Govnor Alex Otti of Labour Party scata di 25 year reign of PDP.
For 2023 Kano State election NNPC remove sitting APC Govnor as di New Nigeria Peoples Party, NNPP candidate for Kano state, North West Nigeria Abba Kabir Yusuf make history to win and become di govnor of di state.
For 2022, Osun State election - PDP remove APC wey bin dey power as Ademola Adeleke of PDP bin win 17 out of 30 local goment areas for Osun govnorship election.
For 2011 Nasarawa State election, di Congress for Progressive Change, (CPC) bin win di April 2011.
Late Govnor Aliyu Dome of di PDP na di sitting govnor dat time, e bin no accept di election result, e carry di mata reach Court wey give judgement say CPC win.
Later CPC join wit Action Congress of Nigeria and one faction of APGA to form APC. Tanko Al- Makura become di govnor under di APC.









