Wetin Nigeria constitution tok about sending military outside di kontri

Wia dis foto come from, STUART PRICE/AFP via Getty Images
Di Nigerian Senate don approve President Bola Tinubu request to deploy some troops to Benin Republic.
President Tinubu request to send Nigerian forces to Benin Republic na for peace mission, sake of di wahala wey di neigbouring kontri don suffer in recent week.
Na for Sunday, some soldiers bin storm one TV station for di Republic of Benin wia dem bin declare say dem don overthrow di civilian govment.
Di coup plotters wey report say dey led by one Pascal Tigri, bin attemot toi remove di current president of Benin Republic Patrice Talon wey don dey office since April 6, 2016 (about 9 years in office as of December 2025.)
Bifor di coup attempt happun, Benin Republic president Talon dey expected to step down for April 2026 afta e complete im second term, as e don tok publicly say e no go seek third term.
Howeva, Benin Republic govment later confam say di coup wey di soldiers try do no succeed.
Nigeria confam say dem part of di kontri wey stand gidigba to help Benin Republic to stop di coup.

Wia dis foto come from, KOLA SULAIMON/AFP via Getty Images
Afta di Benin Republic govment confam say di coup no succeed, one statement from Nigeria President spokesperson Bayo Onanuga, tok say di Nigeria Armed Forces sharply respond to di coup.
Di statement say na afta urgent call from Benin govment, President Tinubu order Nigerian Air Force fighter jets make dem secure Benin airspace and flush out di coup plotters wey take ova National Television station and regroup for one military camp.
Why Tinubu wan deploy Nigerian soldiers to Benin Republic
For di letter wey President Tinubu bin write to di Nigerian Senate, e say e dey veri urgent to help Benin Republic for di wahala wey dem dey face.
Senate president Godswill Akpabio bin read di letter for di floor of di house, wia Oga Tinubu seek di Nigerian senate consent to send troop go Benin Republic for peace mission.
Part of di letter read, "dis request na based on di further request from di govment of Benin Republic for di exceptional and immediate provision of air support by di armed forces of Nigeria."
"Di Senate gatz know say di Republic of Benin dey currently face wit attempted unconstitutional seizure of power and destruction of democratic institutions, Oga Tinubu letter say.
Tinubu say di situation for Benin Republic require 'external and urgent intervention', na why di Nigerian armed forces gatz dey deployed to di kontri.
"Sake of di close brodahood and friendship wey dey exist between Nigeria and Republic of Benin, na our duty to provide support as requested by Benin Republic."
Wetin Nigeria constitution tok about sending Nigerian military outside
According to di Nigeria Constitution for section 5, no member of armed forces go dey deployed outside Nigeria, except di Senate approve am.
Di section of dat Nigeria Constitution also give power to di President to deploy armed forces to anoda kontri, if e sense any threat.
Section 5 (subsection 4(b)) say, "except wit di prior approval of di Senate, no member of di armed forces of di Federation fit dey deployed on combat duty outside Nigeria."
Di subsection 5 come say "...di President, in consultation wit di National Defence Council, fit deploy members of di armed forces of di Federation on limited combat duty outside Nigeria if e dey satisfied say di national security dey under imminent threat or danger."
Nigerian Constitution further add say di President fit seek consent within seven days wey di actual combat go happun, and di Senate also get 14 days to give consent or refuse.
Howeva, for dis case, di Nigerian Senate led by Akpabio don give approval to send troops to Benin Republic sake of di request of di President.

Wia dis foto come from, @Reportercd1/X
Timelines of coups for Benin Republic
Since di 1990 Constitution of Benin and wen di kontri enter democracy for 1991, dem don get several coup attempts for Benin Republic wey no succeed, and di recent one wey some soldiers try no be di first.
Dis na some recent coups for Benin Republic wit dia dates:
- On March 4, 2013, one failed coup attempt hapun for Benin wey Colonel Pamphile Zomahoun lead against di den-President Thomas Boni Yayi. Report tok say Zomahoun try mobilize soldiers to overthrow di govment, but loyal troops quickly stop am. Dem arrest di coup plotters. President Boni Yayi remain for power till e finish im term.
- On September 26, 2024, authorities for Benin arrest three pipo wey dem accuse of planning coup against di govment. Dem no release plenty details about who dem be or dia reason, but di arrest hapun as part of security operation to prevent wahala.
- On December 7, 2025, group of soldiers from Beninese Armed Forces, wey call themselves di Military Committee for Refoundation (CMR) and wey Lieutenant Colonel Pascal Tigri lead, appear for state television and claim say dem don remove President Patrice Talon from office, dissolve national institutions and suspend di constitution. Dem complain about bad security situation for northern Benin, neglect of soldiers wey die and dia families, and alleged favoritism for military promotions. But loyal soldiers quickly take back control, and later President Talon address di nation, e confam say e dey safe and promise say coup plotters go face punishment.









