Fubara, Adeleke and list of oda govnors wey don leave PDP since 2023

Osun state govnor Ademola Adeleke and Rivers state govnor Siminalaye Fubara

Wia dis foto come from, Adeleke/Fubara/Facebook

Read am in 5 mins

Rivers State Governor Siminalayi Fubara don finally join di ruling All Progressive Congress (APC).

Fubara wey be one of di few govnor under opposition Peoples Democracy Party (PDP) bifor tok say im get di go ahead to leave di party.

Wit dis defection, Fubara become di latest PDP govnor wey go comot go join APC.

Fubara confam for di meeting wey e make di announcement say e go see Oga Presido yesterday and 'di reason for di visit no be for personal visit but for state interest consultation.'

"I no wan make any mistake dis time around, and not to step on any landmine wey anyone dey lay for us."

According to Fubara, e say e get di go ahead to comot wia e dey (PDP) 'becos we no get any protection.'

"Di most interesting part of di meeting na wetin you all do dey wait for. We don take dat decision today, we dey move to APC."

Fubara don join di list of govnor wey dem elect under PDP wey later defect go di APC.

Most of di govnors and oda politicians wey don resign from party wey bring dem come power go di ruling party dey often give di need to align wit di central govment as di reason.

Meanwhile, Osun State Govnor Ademola Adeleke don also announce im defection from PDP to Accord party.

Di Govnor announce say e join di Accord Party since 6th November 2026 but reveal am on Tuesday 9 December.

For statement di govnor say, "today, we unveil di Accord Party, our new platform for di good pipo of Osun State. From Osun West to Osun East to Osun Central, dis na our party, our new platform for victory come August next year.

I join Accord Party more dan a month ago, precisely 6th November 2025, as a platform to seek re-election in 2026. Dis na after weeks of consultation and deliberations with stakeholders and opinion leaders."

Govnor Adeleke add say stakeholders and residents of Osun State dey aware di reason why e dey take dis important decision as e intend to pursue a second term in office on di platform of di Accord Party to complete ongoing delivery of good governance and democratic dividends, wey don get commendation both home and abroad.

Adeleke explain say dem choose di Accord Party becos of dia mission of welfarism align with dia passionate focus on citizens and workers' welfare come add say, " since I join, I dey fascinated by di philosophy of dis great party as di primary essence of a govment na di welfare and well being of di pipo."

Osun and Rivers State govnors don join di long list of govnors wey don dump di PDP but while odas join APC, Adeleke join Accord Party much to di surprise of many pipo.

Which oda govnor don comot PDP and which one still dey?

Akwa Ibom state govnor Umo Eno, Enugu govnor Peter Mbah, Bayelsa govnor Douye Diri, and Delta state govnor Sheriff Oborevwori

Wia dis foto come from, Uno Emo/X, Peter Mbah/X, Duoye Diri/X, Sheriff Oborevwori/X

  • Enugu State

On Tuesday, 14 October, Enugu state govnor Peter Mbah bin announce im defection go di APC.

For one state broadcast, Mbah say di reason for im defection na to connect di South-eastern state to di central govment.

Di PDP govnor defect go di ruling party wit members of di National Assembly, State House of Assembly members, councillors, chairmen of councils plus oda strong politicians for di state.

Leadership of di APC arrange one grand reception for Enugu to welcome di govnor.

  • Bayelsa State

Bayelsa State govnor, Senator Douye Diri, put to rest speculations around im rumoured defection from di PDP wen e officially announce im resignation from di party for wetin e describe as "obvious reasons."

On Wednesday, 15 October, for one state executive meeting, e announce say im take di decision afta extensive consultation wit leaders of di state.

"So, today, I don formally resign from di PDP for very obvious reasons," e tok.

Enugu state govnor Peter Mbah during im defection ceremony go di APC

Wia dis foto come from, Peter Mbah/X

  • Delta State

For 23 April, Delta state Governor Sheriff Oborevwori port from i Peoples Democratic Party (PDP) to di ruling All Progressives Congress (APC).

According to informate wey di state commissioner of information, Charles Aniagwu drop outside, di move "bin dey taken to build di bond of love wey dey for our state and to move di cause of security and welfare of our pipo go front and to ensure di development of Delta bicos evri politics dey local".

  • Akwa Ibom State

Akwa Ibom govnor, Umo Eno announce im own port campaign from PDP go APC for 6 June, 2025.

E reveal say di reason for am to port go anoda party na sake of say e no fit guarantee say dem go fit win elections under di PDP.

Oga Eno tok say, "we don work very jard but we know say for national level, our party no dey gel like dat".

As at Wednesday, December 2025, di govnors wey dem elect under di umbrella of di PDP and wey still dey di party include:

  • Ahmadu Fintiri - Adamawa state (North-East)
  • Bala Mohammed - Bauchi state (North-East)
  • Caleb Mutfwang - Plateau state (North-Central)
  • Agbu Kefas - Taraba state (North-Central)
  • Dauda Lawal - Zamfara state (North-West)
  • Seyi Makinde - Oyo state (South-West)

Di ones wey dem elect under PDP wey don comot go join di APC include:

  • Umo Eno - Akwa Ibom state (South-South)
  • Sheriff Oborevwori - Delta state (South-South)
  • Peter Mbah - Enugu state (South-East)
  • Douye Diri - Bayelsa state (South-South)
  • Siminalayi Fubara - Rivers state (South-South)
Delta state govnor plus oda APC leaders hold di party flag following im defection from di PDP to di APC.

Wia dis foto come from, Rt Hon Sheriff Oborevwori/X