Bayelsa State govnor Diri resign from PDP

Douye Diri

Wia dis foto come from, Douye Diri/X

Read am in 3 mins

Bayelsa State govnor, Douye Diri don become di latest in di list of govnors to resign from di Peoples Democratic Party (PDP).

E make di announcement during di State Executive Council meeting for Govment House, Yenagoa di Bayelsa State capital.

Govnor Diri say e dey resign for "obvious reasons " and e no go resign alone as e go wit di 23 members of di Bayelsa State House of Assembly.

Di Govnor no tok weda e don join anoda political party but tori don dey reign say e go soon comot from di PDP.

Dis dey happun just one day afta anoda PDP govnor Peter Mbah of Enugu state officially join di ruling All Progressives Congress (APC).

Tori be say di news of im porting bin create division for di state as some pipo currently approve di move say e go position di state wit di APC federal goment, while odas say e no really go change anytin as di state don dey dominated by di PDP for di last 26 years.

Who be Douye Diri

Govnor Douye Diri start im political career as di Executive Secretary, Centre for Youth Development between 2000 and 2002.

Im become Commissioner for Youths and Sports for 2006-2007 under Goodluck Jonathan governorship and from 2008 to 2012, im bicom member of Governing Council for University of Maiduguri, Borno State.

For 2012, Sen. Diri work as di Deputy Chief of Staff to Governor Henry Seriake Dickson of Bayelsa State but by 2013, im be di Principal Executive Secretary to di Governor of Bayelsa State.

Im enta di green chambers between 2015 and 2019 as di member wey dey represent Kolokuma/Opokuma federal constituency.

On 14 February, 2020, Sen Douye Diri become di 5th Executive Governor of Bayelsa State as im collect certificate of rerun and take oath of office.

Bayelsa State History as PDP State

Although Bayelsa State bin dey created for 1 October 1996, e no be until 1999 wey dem start to dey get democratically elected govnors dem and since dat time na di PDP dey run tins for di state.

Di first govnor of di state for !999, na Diepreye Alamieteseigha wey bin dey office as govnor till December 2005.

Na for 2005 dem impeach am sake of accusation of corruption and na dat time Goodluck Jonathan becom govnor till 2007.

From May 2007, na Timipre Sylva becom govnor under di PDP till January 2012.

Den for 2012, Henry Seriake Dickson win di election and stay for office till 14 February 2020.

Afta Dickson, di present govnor, Douye Diri get mandate to run di state from di 2019 govnorship elections.

PDP govnors wey don port to APC since Tinubu bicom president

Nigerian VP for Delta State

Wia dis foto come from, Delta State Government

Plenti govnors don port go di ruling APC parti since Bola Tinubu bicom president for 2023.

For 2025 alone, apart from oga Diri, na three oda govnors don port go di ruling part APC from PDP.

Enugu state govnor, Peter Mbah port for say na to ginger more collabo wit di Federal goment cause di move.

For early June, di govnor of Akwa Ibom state Umo Eno carry im kaya go di APC say e do am sake of respect to President Tinubu and give more support to di Senate President, Godswill Akpabio.

Delta State Govnor Sherriff port go APC for April say dem no fit continue for inside "sinking boat".

Why all dis govnors dey comot from PDP?

As e dey now, di number of states wey still dey wit di PDP no pass eight.

Dem be Adamawa State govnor Ahmadu Fintiri, Bauchi State govnor Bala Mohammed, Plateau state govnor Caleb Mutfwang, Taraba state govnor Agbu Kefas, and Zamfara state govnor, Dauda Lawal for di Northern Nigeria.

Odas na, Oyo state govnor Seyi Makinde, Rivers state govnor Siminalayi Fubara and Osun state govnor Ademola Adeleke.