Kano State Governorship Election result 2023: Abba Kabir Yusuf, NNPP candidate beat APC Nasiru Gawuna to win

Collage of Kano state govnorship candidates

Wia dis foto come from, Other

Di New Nigeria Peoples Party, NNPP candidate for Kano state, North West Nigeria Abba Kabir Yusuf don make history to win and become di govnor of di state.

Di Independent Electoral National Commission, Inec, declare am winner afta e poll 1,019,602 votes to beat im closest challenger, di ruling party All Progressives Congress, APC candidate Nasiru Gawuna wey poll 890,705 votes.

Millions of Nigerians vote for wetin some sabi pipo say be di most competitive general elections since military rule end.

Nigerians vote to elect govnors and also lawmakers into di state house of assemblies.

Na 18 political parties participate for di polls and unlike di presidential election, na only 28 out of di 36 states of di federation participate for di govnorship polls.

But asides di govnorship election wey happun for 28 states, elections for members of state assembly happun for all di 36 states of di kontri.

According to di Independent National Electoral Commission, Inec, 993 State Houses of Assembly seats bin dey up for grabs.

Na 44 local goment areas dey for Kano state.

Who be Abba Kabir Yusuf?

Second time na im do am for Abba Kabir Yusuf wey win afta e first contest against Govnor Abdullahhi Ganduje for 2019.

E gain popularity afta im appointment as commissioner of works from 2011-2015.

Im campaign bin focus on education wey im say go get high priority if im win.

Move around di map to see di results local goment by local goment

Your device fit no support this visualisation

Na here you go see di complete results of di 28 states wen Inec declare dem

Your device fit no support this visualisation