How di govnorship and state House of Assembly elections happun across Nigeria

Sorting and voting start for many polling units as early as 3pm for some parts of di kontri.

Live Coverage

Helen Oyibo and Victor Ezeama

  1. Sanwo-Olu win Lagos state govnorship election

  2. Inec declare Alex Otti winner of Abia state governorship election

  3. PDP Sim Fubara win Rivers state govnorship election

  4. NNPP Abba Kabir Yusuf make history as e win Kano govnorship poll

  5. INEC declare PDP Sheriff Oborevwori as winner of Delta state governorship election

  6. Una good morning...and bye-bye!

    We dey close dis page wia we bring una live updates of how di govnorship and state house of assemblies election happun across di kontri. But we go open anoda one to bring una di results.

    Join us again later dis morning wen collation centres open across di state and we begin dey bring una di results as Inec begin call dem.

    Bye-bye for now!

  7. Lagos PDP govnorship candidate Jandor win im polling unit

    Olajide Adediran

    Wia dis foto come from, Olajide Adediran

    Wetin we call dis foto, Jandor win im polling unit

    Di govnorship candidate of di Peoples Democratic, PDP for Lagos State, Azeez Olajide Adediranwey pipo sabi as Jandor don win di election for im polling unit.

    Jandor bin vote for Osolu Secondary School, Irewe 1 for Ojo, on Saturday.

    Di PDP get 87 votes, while APC secure 66 votes. Labour party and Action Democratic Party get one vote each.

  8. Breakdown of Nigeria 2023 presidential election result wey show who win wia

  9. EFCC gbab 65 suspects across 28 states sake of vote-buying,

    EFCC gbab 65 suspects across 28 states sake of vote-buying

    Wia dis foto come from, EFCC/FACEBOOK

    Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) say dem arrest ova 65 pipo sake of alleged voter inducement for di govnorship and state House of Assembly elections wey shele on 18 March.

    For statement on dia Facebook page, EFCC say di arrest na across di 28 states wey di elections take place.

    According to EFCC, upon interrogation, di suspects identify demsef as party agents while dem admit say dem dey distribute moni to induce voters.

    Di commission say dem don begin investigation to determine if di suspects guilty.

  10. 'Gbadebo Rhodes-Vivour dey play di victim' - APC tok,

    “Gbadebo Rhodes-Vivour dey play di victim” - APC tok

    Wia dis foto come from, @jidesanwoolu @GRVlagos/Twitter

    Di All Progressives Congress for Lagos State don accuse Labour Party govnorship candidate Gbadebo Rhodes-Vivour say im dey do like victim.

    For statement by Seye Oladejo wey be di party tok-tok pesin for Lagos, dem accuse Rhodes-Vivour say im dey play old trick wit im alleged accusation against di Independent National Electoral Commission.

    “Im accuse di Independent National Electoral Commission (INEC) and di police say dem ‘provoke Lagosians’ and warn say ‘if Lagos catch fire tonight, no be our fault.’ Im say ‘a lot of places still dey under attack by thugs and hooligans of di APC’. Now di LP candidate dey play di victim,” di statement tok.

    APC say “dis old trick no go work’ sake of say “discerning Lagosians know say all na lie deployed to attract sympathy”.

    Di ruling party say dem know need to dey violent sake of say dem dey sure of di “glittering credentials” of dia candidate, Babajide Sanwo-Olu.

  11. Bayelsa govnor praise INEC for conduct of election,

    Bayelsa govnor praise INEC for conduct of election

    Wia dis foto come from, Bayelsa New media

    Bayelsa State Govnor Douye Diri don commend di Independent National Electoral Commission (Inec) for di conduct of di House of Assembly election for di state.

    Di govnor tok say na improvement on di February 25 presidential and National Assembly elections, wey draw so much condemnation.

    Diri describe di electoral process as peaceful, seamless and fast.

    Di govnor yarn dis one afta im cast im vote for Ward 6, Unit 4 Kalama-owei wari for Sampou community, Kolokuma/Opokuma Local Goment Area of di state.

    E commend Inec for di early arrival of officials and materials at di polling units. Di govnor say reports indicate say na so e be across di state.

    Govnor Diri, however, condemn di attack for Constituency 2 for Ogbia Local goment Area wia armed security men and party thugs allegedly run away wit voting materials for four wards.

    E say im don ask di commissioner of police to arrest di pipo wey dey involve and ensure say dem face di law.

  12. 'Election for Lagos dey peaceful' Lagos Commissioner of Police,

    CP Idowu Owohunwa dey monitor some polling units for Epe during di presidential elections

    Wia dis foto come from, Benjamin Hundeyin

    Wetin we call dis foto, CP Idowu Owohunwa dey monitor some polling units for Epe during di presidential elections

    Di Lagos Commissioner of Police, Idowu Owohunwa say elections dey relatively peaceful for di state and na only few places instances of violence happun within di state.

    E say di violence wey happun no reach to affect di general dynamics of di electoral process and e no reach how pipo dey share am for social media, plus police quickly respond to all di issues of violence for di state.

    Di Lagos commissioner confam say dem don make alot of arrest and don recover all di ballot boxes wey thugs snatch and one young man wey im video go viral say e die during di election dey alive and stable.

    “For most part of Lagos state, di election dey peaceful. I personally visit areas like Ikorodu, Badagry, Ikoyi and some oda parts of Lagos, di election dey peaceful and di electorate dey carry out dia obligations peacefully.” Owohunwa tok.

    Wen tori pipo ask am about areas wey violence occur for di state, di CP say im no fit mention di areas as im still dey compile di list and e still dey receive feedbacks from im field officers.

  13. Report of voter apathy for 2023 governorship election

  14. 'We mean wetin we tok and go do wetin we mean' - Presido Buhari tok,

    Nigeria president Muhammadu Buhari dey vote

    Wia dis foto come from, FEMI ADESINA

    Wetin we call dis foto, Nigeria president Muhammadu Buhari dey vote

    Nigeria President Muhammadu Buhari say di outcome of di governorship and State House of Assembly for di kontri go favour di ruling All Progressives Congress, APC as di kontri pipo know say di party “mean wetin e tok, and go do wetin e mean.”

    One tok-tok pesin for inside statement, Garba Shehu wey give dis informate say di president tok say “I dey sure we go win again,” afta e cast im vote for Ward A, Sarkin Yara Polling Unit 003 for Daura, Katsina state.

    E say make electorate follow dia conscience in choosing right leaders as money no dey for pipo to buy vote again like before.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  15. Breaking, Pipo para as BVAS machine no gree upload results for Lagos,

    BVAS machine no gree upload to IRev

    Alidada polling unit 012 ward F3 Okota Lagos wia sorting and counting don end but BVAS machine no gree upload results to IRev.

    Party supporters dey ground dey para say di machine wey bin dey work since don suddenly no fit upload di results.

    Di pipo say dem go wait for INEC officials to upload di results.

    BVAS machine no gree upload to IRev
    BVAS machine no gree upload to IRev
  16. INEC go investigate hitches, take final decision on election for two Rivers LGAs,

    INEC Rec Rivers State
    Wetin we call dis foto, INEC REC Rivers State assure say evri vote go count

    Di INEC Resident Electoral Commissioner for Rivers State, Dr Johnson Alalibo Sinikiem say di commission dey carry out investigation for proper collation and profiling of areas wia dem experience small-small hitches so as to take a decision on weda to conduct election dia.

    Dis dey follow various reports of incidents wey happen for some local goment areas like Degema and Asari-Toru LGAs wey make di governorship and State Assembly elections no hold dia.

    For Asari-Toru LGA, election materials still dey di RAC centre as dem no do distribution of materials becos of non-availability of result sheets.

    Youths and party agents no allow di distribution to go on as dem insist say all di materials needed for the elections - including di results sheets- must dey available before voting materials go go to di various polling units and so di election dia dey suspended.

    Dr Alalibo wey monitor di conduct of di election for about twenty polling units for Port Harcourt City and Obio Akpor LGA observe say though di election dey generally peaceful, e witness very poor voter turn out.

    E assure Rivers pipo say dia votes go count.

  17. Alleged vote buyers injure EFCC operatives for Kaduna state,

    EFCC on election duty
    Wetin we call dis foto, EFCC chop beating from suspected vote buyers

    Suspected vote buyers don attack officials of di Economic Financial Crimes Commission EFCC as dem dey monitor elections for School road, Unguwan Rimi for for Kaduna state.

    Di corruption police for inside statement say di operatives bin dey try arrest di suspect Kabiru Musa, wey dem see for viral video as e allegedly dey transfer money into pipo account to buy dia votes.

    EFCC say as dem dey try arrest am, e begin shout to attract im oda members wey descend on di operatives and use different method beat dem blue, black, some of dem injure seriously.

    Di commission say as dem arrest di suspect finish dey drive go, di syndicate members throw stones plus oda dangerous objects for dia vehicles wey spoil di wind screen.

    Skip X post
    Allow X content?

    Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

    Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

    End of X post

  18. Breaking, LP guber candidate for Lagos GRV lose im polling unit to Sanwo-Olu

    Result sheet for di election result from GRV polling unit

    Wia dis foto come from, Gbadebo Rhodes-Vivour/Twitter

    Labour Party govnorship candidate for di 2023 elections, Gbadebo Rhodes-Vivour, don lose im polling unit.

    GRV lost im polling unit to di sitting govnor of di state, Babajide Sanwo-Olu of di ruling All Progressive Congress.

    Di LP candidate get 18 votes while Sanwo-Olu win wit 29 out of di 50 accredited voters.

    Result sheet for di election result from GRV polling unit
  19. Ex-President Jonathan condemn violence for im local goment

    Ex-President Jonathan condemn violence for im local goment

    Wia dis foto come from, GOODLUCK JONATHAN/FACEBOOK

    Former President Goodluck Jonathan don condemn di burning of electoral items by thugs for state constituency 2, for Ogbia Local Goment Area of Bayelsa State.

    Di former president call on di police to arrest pipo wey carri out di act as e add say Nigeria no go allow some criminal elements to mess up di electoral process.

    Jonathan wey also be former govnor of Bayelsa State tell tori pipo afta e cast im vote say if di police feel challenged, make dem go meet di govnor so dem go fit involve di military to arrest di jaguda pipo.

    Ex-President Jonathan condemn violence for im local goment

    Wia dis foto come from, GOODLUCK JONATHAN/FACEBOOK

    Ex-President Jonathan condemn violence for im local goment

    Wia dis foto come from, GOODLUCK JONATHAN/FACEBOOK

  20. APC Lagos govnorship candidate Babajide Sawno-Olu win im polling unit

    Babajide Sanwo-Olu cast im vote

    Wia dis foto come from, BABAJIDE SANWO-OLU

    Wetin we call dis foto, Babajide Sanwo-olu win polling unit

    APC governorship candidate for Lagos state, Babajide Sanwo-Olu don win im polling unit for Unit 006, Ward E3, Eiyekole, Lagos Island.

    Governorship:

    APC: 121

    PDP: 01

    LP: 02

    ACCORD: 02