Rivers State Governorship election result 2023: Siminialayi Fubara win Tonye Cole, Magnus Abe and odas

Wia dis foto come from, Facebook
Di Independent Electoral Commission, Inec don return di Peoples Democratic Party, PDP candidate Siminialayi Fubara as di govnor-elect of Rivers state.
Fubara poll a total of 302,614 votes to beat im closest rival, Tonye Cole of di All Progressives Congress, APC wey poll 95,274 votes.
Millions of Nigerians vote for wetin some sabi pipo say be di most competitive general elections since military rule end.
Nigerians vote to elect govnors and also lawmakers into di state house of assemblies.
18 political parties participate for di polls and unlike di presidential election, na only 28 out of di 36 states of di federation participate.
But asides di govnorship election wey happun for 28 states, elections for members of state assemblies happun for all di 36 states of di kontri.
According to di Independent National Electoral Commission, Inec, 993 State Houses of Assembly seats bin dey up for grabs.
Na 23 local goment areas dey di oil rich Rivers State wey dey Southern Nigeria and Fubara win all of dem.
End of Di one wey oda users dey read well well
Who be Siminialayi Fubara?

Wia dis foto come from, Facebook/Siminilaye Fubara
Siminialayi Fubara be di govnorship candidate of di Peoples Democratic Party (PDP) for Rivers State for di 2023 elections - afta winning, e don be di govnor-elect.
E be Chartered Accountant wey get Masters degree in Finance, Business Administration.
Sim Fubara na also former director of Finance, former Permanent Secretary and former Accountant General of Rivers State.
E come from Opobo in Opobo/Nkoro LGA for Rivers South-East Senatorial District.
Move around di map to see di results local goment by local goment
Your device fit no support this visualisation
Na here you go see di complete results from di 28 states wen Inec begin declare dem
Your device fit no support this visualisation














