Delta State Governorship election result 2023: Sheriff Oborevwori defeat Ovie Omo-Agege of APC, Ken Pella and Great Ogboru for guber poll result wey Inec announce

Collage picture of Deltas state govnorship candidates from PDP, APC, LP, APGA and SDP

Wia dis foto come from, Other

Di Independent National Electoral Commission don declare Sheriff Oborevwori of di Peoples Democratic Party (PDP) as di winner of di Governorship election for Delta State.

Di state Returning Officer ( SRO) for Delta State, Prof Owunari Abraham Georgewill say Sheriff Oborevwori get 360,234 votes to be aim opponents.

Di Peoples Democratic Party, PDP Govnorship candidate for di Delta state election Honourable Sheriff Oborevwori bin say e remain confident say di party go retain dia hold for di state level despite di outcome of di presidential election.

For di election wey happun on 25 February, Labour Party bin win wit 341,866 votes while PDP come second wit 161,600 votes.

But inside exclusive interview wit BBC Pidgin, di PDP govnorship candidate say di mata of president and govnor na two different tins entirely.

"Di party wey we dey contest wit no be APC, we no beat APC, we beat dem na, you no see di gap we give dem? E tok.

Oborevwori na di current Speaker of di state House of Assembly - e bin say e no dey worried about di line-up of candidates for di upcoming election as who e be go stand out for am.

Na 25 local goment areas dey Delta state.

For di oda results wey Inec declare Deputy Senate President Ovie Omo-Agege of di All Progressives Congress (APC) poll 240,229, Chief Great Ogboru of di All Progressives Grand Alliance (APGA) poll 11,021, while Labour Party candidate, oga Kennedy Pella poll 48,047.

Move around di map to see di results local goment by local goment

Your device fit no support this visualisation

Na here you go see di complete results of di 28 states wen Inec declare dem

Your device fit no support this visualisation