Jubilation as court grant Queen Naomi and odas bail

Wetin we call dis Video, Pipo for Ibadan begin jubilate afta court grant Queen Naomi bail
Read am in 3 mins

Di Oyo State High Court on Monday 13 January grant former queen of Ife, Naomi Ogunwusi, bail in di sum of 10 million naira wit two sureties.

Justice BK Olawoyin wey preside ova di case also grant Oriyomi Hamzat and Abdullahi Fasasi bail in di sum of 10 million naira wit two sureties respectively.

Oda conditions for dia bail be say dia sureties go get landed property for Ibadan.

Court ask di defendants to submit dia international passports and say make dem no grant any media interview until di conclusion of di case.

Dem bin chop arrest sake of di tragic Christmas funfair wey claim di lives of 35 children for Ibadan, di Oyo State capital.

Hamzat na founder of Agidigbo FM while Fasasi na principal of Islamic High School, Bashorun, Ibadan.

One Chief Magistrate Court bin remand dem for Agodi Correctional Facility for December 2024.

During 24 December proceedings, counsel for di three bail applicants present dia arguments bifor di High Court.

Barrister Adekunle Shobaloju, counsel for Hamzat argue say im client no get serious connection to di allegations and charges against am, and claim say im only provide publicity and di venue for di event.

Counsel for Queen Naomi argue say di Chief Magistrate Court lack di constitutional right to remand im client, as e go beyond di court jurisdiction.

Di Attorney General of Oyo State, Abiodun Aikomo, bin argue say make dem deny dia bail requests.

Di Oyo State goment charge di suspects wit 18-count charges wey dey related to conspiracy to commit a felony, namely murder, manslaughter, conspiracy to commit an offence, and criminal negligence.

Di offences dey contrary to and punishable under section 324 of di Criminal Code, CAP 38, Vol II Law of Oyo State, 2000.

People gathered at a court premises
Wetin we call dis foto, Pipo gada for court premises for di case

Seyi Makinde say suspects gatz face trial

Meanwhile, di Oyo State Govnor Seyi Makinde don insist say Queen Naomi Ogunwusi, Oriyomi Hamzat and odas wey chop accuse sake of di stampede wey claim 35 lives for Ibadan gatz face trial.

E yarn dis one for goment house wey dey Ibadan, di state capital, on Monday 6 January

Makinde say pipo don reach out to am say similar incidents happun for oda states for Nigeria, and nobody don go jail.

E say if di entire Nigeria decide say dem no go follow di rule of law, Oyo State no go be like dat.

Makinde pray say such tin no go happun for Oyo State again.

E say no mata how famous di pesin be, justice go dey served. Di govnor add say im no get anytin against bail if court wan grant dem bail.