How 19 to 21 year-olds allegedly kill Uber driver for Lagos

Wia dis foto come from, Getty Images
Seven suspects dey police cell over alleged killing of two Uber drivers for Lagos, police tok.
Police say di suspects get hand in di death of di e-hailing cab drivers for Lekki and Ajah areas of Nigeria commercial capital.
Di State Commissioner of Police, CP Olarenwaju Ishola tok dis one wen e dey tok to tori pipo for di command headquarters on Saturday.
Di CP say officers arrest four and anoda three-gang syndicate for di killing of di drivers in different incidents.
Tori of di killing of Uber drivers don come out from different parts of Nigeria.
In most cases drivers of di e-hailing rides dey come under attack and sometimes dem be victims of car theft.
For di Lagos incident, police say di suspects dey between ages 19 and 21 years old.
"On 9 January, di suspects order for di Uber for Chevron for di Lekki area – dey go Obalende. As dem reach one lonely area for Obalende, dem rob and kill di driver. Dem stab am many times for neck, but unfortunately dem no fit snatch the vehicle.
"Wit di intervention of good Samaritan and pipo wey dey pass, dem catch two suspects and immediately handed dem over to police for further investigation wey lead to di arrest of oda two oda suspects wey dey run.
"Di deadi body of di driver dey one mortuary for Mainland Hospital Yaba and police recover a Toyota Camry Big Daddy. AGL 650 HN and Knives from dem, " e tok.
CP Ishola also tok about anoda incident wey happun on 12 September, 2024.
E say anoda anoda three-man syndicate between ages 32 and 40 years chop arrest for di alleged killing anoda Uber driver, Oluwaseyi Fowler.
"Di arrested suspects confess say dem kidnap di driver for Ajah area of Lagos, murder rob am of im Toyota camry," police tok.
"Dem sell di Toyota camry car wey dem tiff to dia criminal receiver."
Di police oga add say di suspects later lead officers to recover di di deadi body of di driver wey don begin rotten.
E say dem don already charge di suspects to court den advise e-hailing drivers to always dey careful about di passengers.
"If possible, no dey carry more dan one passenger at a time and insist such to search di pesin or make di pesin siddon for front wit you.
"Dis na just di third of its kind wey pipo don report or detect in three months. We no know how many wey don happun, " e tok.










