D-Day 80th anniversary celebrations in fotos and why France invasion of 1944 happun

UK and France dey organise events to mark di 80th anniversary of di Allied invasion of France.

On 6 June 1944, tens of thousands of sojas bin land on five beaches for Normandy, northern France.

Dis na di largest amphibious invasion for di history of warfare, e play crucial role for di defeat of Nazi Germany and di liberation of Europe.

Sixth of June na date wey dey di memories of generations as D-Day, wen mainly US, British and Canadian forces join hand to defeat Germany.

For Gold Beach for Arromanches, Normandy, Major Trevor Macey-Lillie, wey be piper wit di Scottish gunners, Perform one time-honoured tradition of playing Scottish lament on di bagpipes.

Di tradition bin recreate di exact moment thousands of British troops disembark for French beaches.

Pipo bin gada early to attend di event for Gold Beach.

Later on, Prime Minister Rishi Sunak bin speak for UK commemorative event for di British Normandy Memorial for Ver-sur-Mer.

"80 years ago, di weather break," im tok, as im begin im address, "and di greatest invasion force for history bin leave di shores of Britain to liberate Europe."

Oga Sunak go on to say we "pledge say we no go eva forget" wetin pipo bin sacrifice for D-Day landings, im add say veterans bin dedicate dia lives to tell odas wetin happun.

British cadets and French primary schoolchildren welcome King Charles III and Queen Camilla as dem arrive for di Royal British Legion commemorative event.

Dem join a number of Western leaders, including US President Joe Biden and French President Emmanuel Macron, to mark di 80th anniversary of di D-Day landings.

Di King bin address veterans for di British Normandy Memorial for Ver-sur-Mer. E say allies bin face di "supreme test" 80 years ago and we dey fortunate say di D-Day generation no shake wen "di time come to face dat test".

Dis na di first time di memorial, wey contain di names of di 22,442 servicemen and women under British command wey fall on D-Day and during di Battle of Normandy for di summer of 1944, go dey used for major anniversary commemorations, afta dem open am for 2021.

King Charles III bin lay wreath for di British Normandy Memorial, wit one note wey im attach wey touch on di sacrifices wey dem make on D-Day.

French President Macron and Prime Minister Rishi Sunak follow dem lay wreaths for di event to mark di anniversary.

Di Red Arrows, alongside one Eurofighter EF-200 Typhoon, do flypast.

President Macron award 104-year-old British World War II veteran, Christian Lamb, di insignia of Knight in di Legion of Honour.

Wren officer Christian Lamb, one veteran officer for di Women Royal Naval Service, na im help plan di D-Day landings from Winston Churchill secret war rooms for London.

Di Prince of Wales bin attend di Canadian commemorative ceremony to mark di 80th anniversary of D-Day, for Juno Beach Centre for Courseulles-sur-Mer.

Canadian Prime Minister Justin Trudeau and France Prime Minister Gabriel Attal greet Prince William.

Di Prince tank Canadian veterans for dia "extraordinary acts of bravery and sacrifice".

"We continue to honour evri Canadian wey bin give so much, evri Canadian family wey lose dia loved one," im tok.

Im end im speech for French say: "Tank you for our freedom, and tank you for your service."

Canadian veteran Jim Spenst bin speak to oda veterans bifor di commemorative ceremony for di Canadian cemetery, wey bin include a descent by Canadian paratroopers near di village of Courseulles-sur-Mer.

US President and First Lady Jill Biden bin meet World War Two veterans for di Normandy American Cemetery for Colleville-Sur-Mer.

Military fly-past bin greet dem as dem arrive for di D-Day memorial ceremony for Omaha Beach, wit French President Emmanuel Macron and im wife Brigitte.

Dem bin hand di Légion d’honneur, France highest medal of honour, to surviving veterans, ahead of President Biden speech.

Following di address from US Secretary of Defense Lloyd Austin, President Biden speak of di climate wey bin lead-up to D-Day, and im remember di millions of Jewish pipo wey die for Holocaust, and di millions of odas wey die for di "bloody warfare".

E say: "On behalf of di American pipo, na di highest honour to salute una for Normandy once again. God love una."

Oga Biden tank di forces wey "do dia duty" on D-Day - and im ask di audience weda dem go do di same in our "hour of trial".

Im end to say modern nations must dey "worthy of dia sacrifice" in order to honour dose wey bin fight and die.