Vladimir Putin say im ready to compromise wit Donald Trump on Ukraine war

Wia dis foto come from, Getty Images
Russia President Vladimir Putin on Thursday tok say e dey ready to compromise ova Ukraine in possible tok-tok wit US President-elect Donald Trump on ending di war.
Putin tok say im no get conditions for starting tok-tok wit di Ukrainian authorities.
Trump bin vow to swiftly end di conflict, but e neva give any detail on how e fit achieve dat.
Wen im bin dey answer questions on state TV during im annual question and answer session with Russians, Putin tell tori pesin of one US news channel say im dey ready to meet Trump, wey im neva speak wit for years.
Wen dem ask am wetin im fit offer Trump, Putin dismiss assertion say Russia dey weak position, and add say Russia don dey much stronger since im order troops into Ukrain for 2022.
"We don always tok say we dey ready for negotiations and compromise," Putin tok. E say Russian forces wey dey advance across di entire front dey move towards achieving dia primary goals for Ukraine.
"Soon, dose Ukrainians wey wan fight go run comot, in my opinion, soon nobodi go remain wey wan fight.
We dey ready, but di oda side need to dey ready for both negotiations and compromises," e tok.
Reuters bin report last month say Putin bin dey ready to discuss a Ukraine ceasefire deal wit Trump, but im rule out making any major territorial concessions and insist make Kyiv abandon dia ambitions to join Nato.
Putin bin tok on Thursday say Russia bin no get conditions to start tok-tok wit Ukraine and bin dey ready to negotiate wit anyone, including President Volodymyr Zelensky.
But im say na only legitimate authorities dem fit sign any deal wit for Ukraine, wey for now Russia consider to be only di Ukrainian parliament.
Zelensky, wey im term don technically expire but wey don delay election sake of di war, go need to dey re-elected for Moscow to consider am as legitimate signatory to any deal to make sure say e dey legally watertight, Putin tok.
Putin dismiss di idea to agree to a temporary truce wit Kyiv, im say na only a long-lasting peace deal wit Ukraine dem want.
Any tok-tok go be di starting point for preliminary agreement wey Russian and Ukrainian negotiators bin reach for di early weeks of di war during tok-tok for Istanbul, wey dem no even implement, im add.
Some Ukrainian politicians regard dat draft deal as wetin for neutralise Ukraine military and political ambitions.










