Cyril Ramaphosa dey re-elected as South African president

Cyril Ramaphosa

Wia dis foto come from, Getty Images

South Africa parliament don re-elect Cyril Ramaphosa as di kontri president afta a landmark coalition deal between di governing African National Congress (ANC) and opposition parties.

Di new goment of national unity combine Mr Ramaphosa ANC, di centre-right Democratic Alliance (DA) and smaller parties.

For im victory speech, Mr Ramaphosa hail di new coalition, and tok say voters expect di leaders "to act and to work togeda for di good of evri one for our kontri".

Dem make di agreement on a day of high political drama, wey see di National Assembly sitting late into di evening for votes to confirm who go hold power for di new administration.

Earlier, dem strike deal afta weeks of speculation about who di ANC go partner wit afta losing dia parliamentary majority for di first time in 30 years for last month elections.

Dem get 40% of di vote, while di DA come second wit 22%.

ANC secretary-general Fikile Mbalula call di coalition deal a "remarkable step".

E mean say Mr Ramaphosa - wey bin replace Jacob Zuma as both president and ANC leader afta a bitter power struggle for 2018 - dey able to retain power.

Di next step na for Mr Ramaphosa to allocate cabinet positions, wey go include members of di DA.

Di multi-party deal no involve two ANC breakaway parties, and dem fit benefit e fail to deliver economic improvements wey voters dey demand.

But opinion polls suggest say many South Africans want dis unprecedented grand coalition to succeed.

Di ANC don always poll above 50% since di kontri first democratic elections for 1994, wey see Nelson Mandela become president.

However, support for di party don dey drop significantly becos of anger sake of high levels of corruption, unemployment and crime.

Addressing South Africa parliament afta im confirmation, Mr Ramaphosa make reference to im party first presidential victory 30 years ago.

"We don dey here bifor, we bin dey here for 1994, wen we bin seek to unite our kontri and to effect reconciliation - and we dey here now," e tok.

An alliance between di centre-right DA and di ANC dey unprecedented as di two parties don be rivals for decades.

Under Nelson Mandela, di ANC bin lead di campaign against di racist system of apartheid and win di kontri first democratic elections.

Di DA critics bin don accuse ANC say dem bin dey try protect di economic privileges di kontri white minority build up during apartheid - but ANC deny dis allegation.

Addressing lawmakers on Friday night for Cape Town, John Steenhuisen, di leader of di DA, say: “Today na historic day for our kontri, and I tink na di start of a new chapter.”

Di National Assembly also swear in a speaker from di ANC, while di post of deputy speaker go to di DA.

Among di party leaders speaking afta dem reach agreement on Friday na Julius Malema, head of di Economic Freedom Fighters - di party e found afta im leave di ANC for 2013.

E say while im party accept "di results and di voice of di pipo of South Africa", e criticise di agreement, and say: "We do not agree to dis marriage of convenience, to consolidate di white monopoly power ova di economy and di means of production for South Africa."