Transfer gossip: Arsenal dey chase Spain striker Mayoral, Madrid consider Haaland, oda transfer latest

Wia dis foto come from, BBC Sport
Real Madrid dey assess di prospect to sign Manchester City and Norway striker Erling Haaland, 23, sake of worry about whether France forward Kylian Mbappe, 25, go comot Paris St-Germain to join dem. (AS - in Spanish)
England winger Jadon Sancho, 23, don land for Borussia Dortmund to complete one loan move to im former club afta e fall out of favour for Manchester United. (Sky Sports)
Chelsea midfielder Conor Gallagher, 23, remain top of Tottenham list as Spurs look to bring one midfielder for January, as di Blues wan do one deal for di England international for di right price. (Independent)
Newcastle United don hear say one English striker Dominic Solanke no go dey sold dis month afta one enquiry for di 26-year-old Bournemouth forward. (Telegraph - subscription required)
Arsenal don make one £22million bid for Getafe and Spain striker Borja Mayoral, 26. (Sun)
Manchester United forward Anthony Martial don turn down approach from Fenerbahce, Marseille and one Saudi Pro league side, as di 28-year-old Frenchman set to stay for Old Trafford until im contract run out for summer. (Athletic - subscription required)
Manchester United don offer Uruguay winger Facundo Pellistri, 22, for swap deal for SportingLisbon and Denmark midfielder Morten Hjulmand, 24, but di bid don dey rejected sake of Hjulmand get £69m release clause. (Sun)
West Ham dey weigh up making bids for Ajax Dutch forward Steven Bergwijn, 26, and Sunderland English winger Jack Clarke, 23, as dey look to sign one attacking player for January. (Telegraph - subscription required)
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Hammers don rule out one move for former Manchester United and England midfielder Jesse Lingard, 31. (Daily Mail)
Brentford and Crystal Palace also get interest for Clarke, wey bin dey Tottenham bifo e join Sunderland.(Evening Standard)
Brighton don join di race for Serbian attacking midfielder Lazar Samardzic as Napoli don gree to one deal wit Udinese for di 21-year-old. (Sky Sports Germany)
Wolves no dey under pressure to sell Max Kilman, wit West Ham link to di 26-year-old English defender. (Mail)
Wolves don make one move for 27-year-old Scotland striker Che Adams, wey im contract for Southampton run out for summer. (Football Insider)
Spanish club Sevilla na favourites to sign Manchester United and Tunisia midfielder Hannibal Mejbri, 20, on loan for di rest of di season. (Manchester Evening News)
Napoli fit make one move for Arsenal Poland international Jakub Kiwior, 23, and Chelsea French defender Malang Sarr, 24, as dey look to bring in one centre-back for January. (La Repubblica, via Football Italia)
Uruguay defender Ronald Araujo, 24, say e dey focus on Barcelona for middle of links to Bayern Munich. (Mundo Deportivo - in Spanish)

Wia dis foto come from, BBC Sport
France and Paris St-Germain forward Kylian Mbappe, 25, don agree one deal to join Real Madrid for di end of im contract. (Foot Mercato - for French)
Madrid don offer Mbappe, wey im deal for PSG end dis summer, less money dan dey bin do for dia tok for 2022. (Athletic - subscription required)
However, Mbappe fit yet make one move to di Premier League. (Times - subscription dey required)
Juventus don pull out of di race to sign Manchester City and England midfielder Kalvin Phillips sake of di loan fee and di breakdown of di 28-year-old salary.(Fabrizio Romano)
Di Serie A club don also drop dia interest for Tottenham and Denmark midfielder Pierre-Emile Hojbjerg, 28, wit di fee wey prove too costly. (The Sun)
Di end of Juve interest for Phillips fit boost Newcastle chances to sign in di midfielder. (Mail)
Liverpool fit land one seven-figure windfall if England midfielder Jordan Henderson, 33, dey sold by Saudi Arabian side Al-Ettifaq. (Mirror)
Everton don set one £60m fee for Amadou Onana wit Arsenal wey dey look to make one move for di 22-year-old Belgium midfielder. (Football Insider)
Chelsea, Manchester United and AC Milan all dey watch Nice and France defender Jean-Clair Todibo, 24, but di French club hope to keep hold of am for di January transfer window. (RMC Sport - in French)
Barcelona don reportedly dey offered chance to sign former Manchester United and England midfielder Jesse Lingard. Di 31-year-old na free agent since e comot Nottingham Forest for end of last season. (Sport - in Spanish)
England forward Ivan Toney, 27, tok say e get "unfinished business" as e dey prepare to make im return for Brentford afta e serve one eight-month suspension sake of e breach betting rules. (Mirror)














