Where be Greenland and Why Trump want am?

Wetin we call dis Video, Watch: Trump say US need Greenland and Canada for 'national security'
    • Author, Alys Davies
    • Role, BBC News
    • Author, Mike Wendling
    • Role, BBC News
  • Read am in 6 mins

President-elect Donald Trump don again express im desire for America to take ova Greenland and di Panama Canal, as e say both of dem dey critical to American national security.

Wen dem ask am if e go rule out using military or economic force in order to take take ova di independent Danish territory or di Canal, e say: "No, I no fit give you dat assurance.

"But I fit tok say, we need dem for economic security," e tell tori pipo during one wide-ranging news conference for im Mar-a-Lago estate for Florida.

Both Denmark and Panama don reject any suggestion wey involve say dem go give up dia territory.

Wetin we call dis Video, Watch: Danish PM say "Greenland na for di Greenlandic pipo"

Trump also vow to use "economic force" wen dem ask am if e go attempt to take ova Canada as e call dia shared border an "artificially drawn line".

Di boundary na di longest boundary for di world between two kontris and e dey established for inside treaties wey date back to di founding of di US for di late 1700s.

Di president-elect tok say US dey spend billions of dollars to protect Canada, and e criticise di importation of Canadian cars, lumber and dairy products.

"Dem suppose be state," e tell tori pipo..

In recent weeks, Oga Trump bin repeatedly tok say Canada go become di 51st US state.

But outgoing Canadian Prime Minister Justin Trudeau say chance no dey for hell for di two kontris to merge togeda.

Trump news conference - less dan two weeks bifor dem swear am in for a second term – suppose be economic announcement to unveil one $20bn (£16bn) investment from Dubai developer Damac Properties to build data centres for US.

But for one free-wheeling appearance, di president-elect bin go on to condemn environmental regulations, di US election system, di various legal cases against am, and President Joe Biden.

Among oda tins, e suggest to rename di Gulf of Mexico di "Gulf of America" and restate im opposition to wind power, e say di wind turbines dey "drive di whales crazy".

One aircraft wey dem write Trump wey dey carry Donald Trump Jr bin land for one airport for Nuuk, Greenland.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Donald Trump Jr tok say im visit to Greenland na "personal day trip"

Where be Greenland?

Greenland, di world largest island, dey located for di Arctic.

Na one territory wey get small population for di world.

About 56,000 pipo dey live for there, mostly indigenous Inuit pipo.

About 80% of dia territory dey covered by ice, wey mean say most pipo dey live on di south-western coast around di capital, Nuuk.

Greenland wey be independent territory of Denmark, also na home to Danish and US military bases.

Di economy mainly na fishing. Large subsidies from di Danish government account for about one fifth of GDP.

In recent years, increased interest don dey for Greenland natural resources, wey include mining for rare earth minerals, uranium and iron. These fit become more accessible as global warming dey make some of di ice wey cover Greenland to melt.

Wetin be Greenland status?

Map show di location of Greenland and di capital Nuuk.

E dey located geographically within North America. Na Denmark wey dey nearly – 3,000 km (1,860 miles) away dey control Greenland – for about 300 years now.

Na one colony bin dey govern di island until di mid-20th Century. For most dis time, e remain isolated and poor.

For 1953, e become part of di Kingdom of Denmark and Greenlanders become Danish citizens.

For 1979, one referendum on home rule give Greenland control of most policies within di territory, and Denmark retain control over foreign affairs and defence.

Why Greenland mata to di US?

Di US for long don maintain security interest for Greenland. Afta Nazi Germany occupy mainland Denmark during World War II, US bin invade Greenland, and establish military and radio stations across di territory.

Afta di war, US forces remain for Greenland. Na US since then dey operate Pituffik Space Base, wey formerly dey known as Thule Air Base.

For 1951, one defence agreement wit Denmark bin grant di US ogbonge role for di defence of di territory, wey include di right to build and maintain military bases.

"If Russia wan send missiles go di US, di shortest route for nuclear weapons go be via di North Pole and Greenland," Marc Jacobsen, one associate professor for di Royal Danish Defence College tok.

"Dat na why di Pituffik Space Base dey very important in defending di US."

China and Russia don begin build up dia Arctic military capabilities in recent years, according to one Arctic Institute paper. Di paper ask US to further develop dia presence for di Arctic to counter dia rivals.

On Wednesday, Danish Foreign Minister Lars Lokke Rasmussen tok say Denmark dey open to discussions wit di US, and add say Washington get "legitimate" interests for di region.

"We see a Russia wey dey arm itself. We see a China wey also don start to take interest," Rasmussen tok.

Trump also likely dey interested for di mining potential across Greenland vast landmass, Mr Jacobsen add.

"Today, of special interest na di rare earth minerals, wey dem neva mine bifor but dey for di southern part of Greenland. These dey very important in all kinds of technologies, from cell phones to wind turbines."

US want full control of Greenland?

Image show Donald Trump

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di president-elect say di US need Greenland for "economic security"

Trump don claim say di control of Greenland dey essential to US national and economic security.

Though di president-elect tok fit sound unusual, for more dan one century, different US presidents don try to gain control of Greenland.

"Di US don try for few times to push di Danes out of Greenland and take am ova as part of di US, or at least to get full security tutelage of Greenland," Lukas Wahden, di author of 66° North, one newsletter on Arctic security tok.

For 1867, afta dem buy Alaska from Russia, US Secretary of State William H Seward laed negotiations to buy Greenland from Denmark, but e fail to reach any agreement.

For 1946, US bin offer to pay $100m (equivalent to $1.2bn; £970m today) for di territory, as dem say e go dey vital for national security, but di Danish goment refuse.

Trump also try to buy Greenland during im first term. Both Denmark and di Greenlandic goment reject di 2019 proposal, dem say: "Greenland no dey for sale."

Wetin di pipo of Greenland think?

Kuno Fencker, one member of di Inatsisartut, di Greenlandic parliament, on Wednesday tok say im no see Trump comments as threat.

Fencker, wey support Greenlandic independence, tell BBC say a sovereign Greenland fit choose to co-operate wit di US on defence.

But wen Trump bin first raise di idea of buying Greenland for 2019, many locals tell BBC say dem no go gree for di proposal.

"Dis na very dangerous idea," Dines Mikaelsen, one tour operator wey dem born and raise for Tasiilaq, east Greenland tok.

"E dey treat us like market wey e fit buy," Aleqa Hammond, Greenland's first female prime minister tok.

"E no even dey follow Greenland tok – e dey tok to Denmark about buying Greenland."