New fire burst out for Hollywood Hills as commotion grip Los Angeles
Na at least seven fires don dey for Los Angeles and some of dia neighbouring counties.
Di largest two, for di Palisades and Eaton, first start on Tuesday and don burn nearly 27,000 acres since.
At least 137,000 pipo don dey forced to leave sake of dia fire alone.
Among di oda blazes na di Hurst Fire, wey broke out for di Sylmar neighbourhood north of San Fernando, and di Sunset Fire, wey recently erupt start for Hollywood Hills, near Runyon Canyon.
Tori break on Wednesday night say di fire don spread reach Hollywood Hills and Studio City.
Several houses appear to don catch fire for Studio City just before 9pm.
Di LA Fire Chief Kristin Crowley say na four fires dey burn and stretch di limits of emergency services. Dem be Palisades, Eaton, Hurst and Woodley.
She add say many civilians and firefighter dey part of who don injure and some of di injury dey significant
For press conference, di oga of di Los Angeles County Board of Supervisors, Kathryn Barger bin warn pipo say make dem listen to first responders as all di four fires no dey contained at all.
Fire Chief Anthony Marrone tok say di Palisades fire burn ova 5,000 acres and 1000 structures.
For di Eaton fire, na 2000 acres burn wit ova 100 structures destroyed.
E tok say all di residents of Los Angeles county dey in danger.
Di Superintendent of Los Angeles Unified School District Alberto Carvalho tok say LA County shut down 100 out of 1000 schools sake of di fire.
Authorities for Los Angeles don declare state of emergency as wildfire from three different locations explode from 10 acres to more dan 2,900 acres inside hours.
Three areas for di city dey burn at di same time, Pacific Palisades wia Hollywood celebs dey live, Altadena, near di Eaton Canyon, and Sylmar surburbs.
More dan fifty acres don burn for Sylmar suburbs, wia authorities don give mandatory evacuation order as firefighters say di flames dey grow very fast.
Los Angeles fire chief, Kristin Crowley, give order make more dan 30,000 pipo leave dia house, as two more fire dey spread to di north-west part of di city.
Plenty dramatic foto and video dem show as houses dey born for di Pacific Palisades area and as pipo dey abandon dia cars to run from di fire.
Di fire wey begin burn around 10:30 (18:30 GMT) on Tuesday – don sharply spread sake of di very weather plus high winds.
Wind storm bin dey steadily increase since night and di most recent observations show say heavy wind of up to 60-70mph on top higher ground dey blow toward Angeles National Forest and Santiago Peak.
Dis very dry winds wey dey come from di mountain wey dey di north and east and down to di coast of Los Angeles na im dem dey call "Santa Ana winds".
For di waterside, di kain wind wey wey don blow for di last few hours reach up to 40-50mph (64-80kmh). And BBC Weather forecast say di winds go kontinu to blow di fire go down towards di city.

Wia dis foto come from, Reuters
I never experience dis kain day like for Los Angeles
Area pipo just dey watch as di fire dey collect everytin wey dem own and dem no get any idea wia to go.
BBC reporter, Regan Morris, say although dem dey use to wildfire for Los Angeles, for more dan 20 years wey im don live for di city, im never experience dis kain one before.
Di massive fire dey burn close to areas wia pipo plenty. Pipo near dis areas no know weda make dem go sleep or not becos dem no know weda dem go need to run.
Amrita Khalid, one journalist wey dey live for coastal city of Santa Monica, bin evacuate not too long ago.
She tell BBC World Service Newsday radio programme say "I no fit stress to you how normal dis morning bin be for Santa Monica. E bin just be like anoda winter morning. But den, as I dey waka hom from gym, I just notice big black clouds of smoke."
Amrita say she decide to leave her house go safer location and she happy say she leave becos di kain foto from her area wey she bin later see make her know say she do di right tin.
"E look like Mars, e look bright red," she say. "So somehow I happy say I leave. I tink e beta to dey safe dan sorry."

Wia dis foto come from, Reuters
No possibility of managing di spread as 1,400 firefighters dey ground
Firefighters wey dey tackle di Palisades wildfire as e dey burn dey go say e no dey possible to maintain spread of di fire sake of high winds.
David Acuna, battalion chief and public information officer wit California Department of Forestry and Fire Protection (CAL), tell tori pipo CNN.
Acuna say di main concern of CAL na to "make sure all di pipo get out of di area becos life safety n aim be di most important part, and weedy help pipo plan so di pets and livestock go also get safe shelter."
Dis dey come as governor for California, Gavin Newsom, say dem send more dan 1,400 firefighters to fight di "unprecedented fires" for Los Angeles and hundreds more staff dey "pour in from across di state".
"Emergency officials, firefighters, and first responders all dey ground dey work since night to do everytin possible to protect lives," im write on X.

Wia dis foto come from, Reuters











