What next for Chidimma Adetshina mama as South Africa authorities detain am?

Foto of Chidimma Adetshina
Read am in 4 mins

Home Affairs for South Africa don detain Chidimma Adetshina's mama, Anabela Rungo.

For one statement wey dem issue on Saturday 15 February, Home Affairs say dia investigators assisted by di South African Police Service detain Rungo for Cape Town on Saturday morning.

Home Affairs say dem withdraw Rungo South African documentation for September 2024 afta dem discover say she obtain am fraudulently.

According to Home Affairs, dis mean say she no dey eligible to continue to dey live for South Africa.

"In an apparent act of brazen disregard for di legal consequences of her conduct, e appear say Ms Rungo don defy her 'undesirable' status through her Mozambican passport," Home Affairs tok for di statement.

"Investigations dey go on into further potential misrepresentation and fraudulent conduct."

Home Affairs say dem see Miss Adetshina pikin dey live wit Rungo at di property for Cape Town.

Dem say dis don lead dem to work wit di South African Police Service (SAPS) and di Department of Social Development to ensure di safety and well-being of di pikin.

"Afta Home Affairs process am sake of her apparent illegal continued residence for South Africa, Mrs Rungo go dey handed ova to di SAPS as she also be subject of one ongoing investigation by di Directorate for Priority Crime Investigation," di statement tok.

What next for Chidimma Adetshina mama?

Home Affairs bin withdraw Anabela Rungo South African documentation afta dem find out say she fraudulently obtain am.

Once Home Affairs declare pesin document invalid, di pesin get two options.

Either make di pesin live di kontri on dia own or dey detained and deported.

Wetin SA law tok about illegal immigrants

According to section 30 of Immigration Regulations ambeded in (2018) unda di Immigration Act, 2002, if di travelling document of any illegal foreigners don expire, e get 14 days to leave di kontri or reapply for di approval of Director-General to remain for di kontri.

"Upon requesting authorisation as contemplated in section 32(1) of di Act, illegal foreigner wey dem neva arrest for di purpose of deportation and e wish to apply for status afta di date of expiry of im visa, gatz:

"Demonstrate, in writing, to di satisfaction of di Director- General say e don submit proof to immediately submit im or her application for status."

Meanwhile section 33 (4) (b, c) tok say if dem arrest any illegal foreigner for South Africa, e get three days to write for legal representation and 25 days to apply for di court for di hearing of im immigration status.

"Afford di detainee di opportunity to write for legal representations within three days of di notification and within 25 days following di arrest of di detainee, submit wit di clerk of di court application for di extension of di period of detention," e tok.

While section 33 (10) tok say if dem find any illegal foreigner guilty, dem go carry am to di port entry and hand am ova to im kontri of nationality for deportation.

Who be Chidimma Adetshina

Chidimma Adetshina

Chidimma Adetshina na Nigerian-South African beauty pageant titleholder.

Dem born am for 8 January 2001 for Soweto, South Africa to Nigerian papa and Mozambican mama.

Adetshina bin pursue law degree and for 2024, she welcome her baby boy.

For 2024, Adetshina pageantry journey begin wit her participation in di Miss South Africa competition.

However, her involvement bin cause tok-tok sake of di questions wey surround her citizenship and eligibility, wey lead to her withdrawal from di pageant.

Investigation by di Home Affairs for South Africa into her mama citizenship make di situation worse, and Miss Adetshina enta di Miss Universe Nigeria pageant wia she represent Taraba State.

For August 2024, dem crown am Miss Universe Nigeria, wey earn am di opportunity to represent di nation at di Miss Universe 2024 pageant wey shele for Mexico.

At di Miss Universe 2024 competition, Miss Adetshina secure di first runner-up position, and dis mark Nigeria highest placement in di pageant history.

Additionally, dem honour am wit di title of Miss Universe Africa and Oceania as di highest-ranked contestant from di region.