12 year old boy kill one and wounjure two for Finland

Police don reveal say di 12 year old suspect wey kill one boy and injure two girls for school shooting bin do am sake of bullying.

Di boy wey dem gbab not too far from im school, bin open fire on oda students on Tuesday morning one hour bifor dem catch am.

Im victims na 12 year old pikin dem be, and di two girls still dey hospital.

Police buildings all ova Finland bin lower dia flags on Wednesday to mark mourning for di attack.

For statement, police say na for di beginning of di year di boy bin do transferred to di school .

Dem say di suspect tell dem say pipo bin dey bully am afta dem catch am almost 4km away from wia e shoot pikin dem. Dem add say dia first investigation also support dat claim.

Police don open investigation into di murder and attempted murder but bicos of im age, dem no fit hold am criminally responsible and now e dey di hands of social services.

Police also reveal say di suspect bin dey threaten students as dem dey waka go school for Vantaa.

According to local TV channel, MTV Utiset, e bin wear mask and noise-cancelling headphones wen e bin dey shoot for di school.

Di school open on Wednesday o but di deputy mayor say e go close earlier dan usual.

Di Viertola school for Vantaa get 800 students wey dey between di ages of seven and 16 and na about 90 staff dey work for di school.

Di deputy mayor tok say dem dey offer beta support to di staff and students and dem go discuss di shooting proper for schools around Vanta wey be di fourth largest city for Finland.

Wetin happun for di shooting?

Di school bin just resume from dia long Easter weekend wen di attack happun as all of dem wey dey inside di attack dey sixth grade.

Di suspect bin run comot di school as police come but police soon catch am one hour later for di northern Siltamaki district of Helsinki.

One video wey car wey dey pass bin record show as dem pin di suspect for side of di road almost 4km away from di school.

Police say e bin dey hold di gun wey dem collect from im hand bifor im confess to di shooting.

Police don confam say di gun wey di suspect use, na from close family member im collect am.

Gun ownership na big mata for Finland as pipo wey don reach 18 years and dey seen as fit to get firearm fit apply for license while pikin wey don pass15 years fit get licence to use oda pipo, dia guns.

Tori be say di suspect use one revolver type handgun wey dem bin license give one close family member.

And for Finnish law, dem dey only give permits for revolvers to pipo wey pass 20 years old.

Elina Pekkarinen, wey be Finland Children Rights Ombudsman tell Finnish tori pipo STT, say "for years we don dey tok say make we take violence between pikin dem society serious."

She add say acts of violence most especially wit pikin wey neva reach 15 don dey rise for several years.

Finland dey popular as di kontri of hunters and pipo wey like guns and get 430,000 licensed gun owners for dia 5.6 million population, according to goment statistics.

Limit no dey to how many guns pesin fit own and di interior ministry say e pass 1.5 million guns wey dey for inside di kontri.