Ballon d'Or 2025 nomination - who dey di list

Ballon d'Or trophy

Wia dis foto come from, FRANCK FIFE/Getty Images)

Read am in 5 mins

Dem don announce nominees for di 2025 Ballon d'Or and different players wey dey di list.

Dem go announce di winners of di 2025 Ballon d'Or on 22 September 2025 during ceremony for di Theatre du Chatelet for central Paris.

Only three players oda dan Lionel Messi and Cristiano Ronaldo don win di Ballon d'Or since 2008.

Messi and Ronaldo win di award 14 times ova 16 years between 2008 and 2023.

Luka Modric end dia dominance by winning di 2018 prize afta e guide Real Madrid to third successive Champions League title and Croatia to dia first World Cup final dat year.

Karim Benzema earn di award for 2022 while for 2024, Rodri, wey lose just one game during di 2023-24 season for club and kontri, become di first Spanish player to win di men award since 1960 and di first Premier League player to win di award since Ronaldo for 2008.

Rodri help Spain win Euro 2024 and also win di Premier League, Uefa Super Cup and Club World Cup wit Manchester City for 2023-24.

Rodri claim di award ahead of Real Madrid and Brazil winger Vinicius Jr and im team-mate Jude Bellingham wey come third.

Foto of Rodri wey dey hold im Ballon d'Or trophy 2024

Wia dis foto come from, Franck Fife / AFP via Getty Images

Women's Ballon d'Or nominees

Spain and Barcelona midfielder Aitana Bonmati, wey don win di award both for 2023 and 2024, dey di shortlist again.

  • Lucy Bronze (Chelsea & England)
  • Barbra Banda (Orlando Pride & Zambia)
  • Aitana Bonmati (Barcelona & Spain)
  • Sandy Baltimore (Chelsea & France)
  • Mariona Caldentey (Arsenal & Spain)
  • Klara Buhl (Bayern Munich & Germany)
  • Sofia Cantore (Washington Spirit & Italy)
  • Steph Catley (Arsenal & Australia)
  • Melchie Dumornay (Lyon & Haiti)
  • Temwa Chawinga (Kansas City Current & Malawi)
  • Emily Fox (Arsenal & USA)
  • Cristiana Girelli (Juventus & Italy)
  • Esther Gonzalez (Gotham & Spain)
  • Caroline Graham Hansen (Barcelona & Norway)
  • Patri Guijarro (Barcelona & Spain)

Kopa Trophy nominees (Men)

Hia na di full list of 2025 Kopa Trophy nominees, and some big names dey dia:

PSG duo Desire Doue and Joao Neves dey joined by Barcelona Lamine Yamal, wey fit dey among di contenders for di main prize as well.

  • Pau Cubarsi (Barcelona & Spain)
  • Ayyoub Bouaddi (Lille)
  • Desire Doue (PSG & France)
  • Estevao Willian (Chelsea & Brazil)
  • Dean Huijsen (Real Madrid & Spain)
  • Myles Lewis-Skelly (Arsenal & England)
  • Rodrigo Mora (Porto & Portugal)
  • Joao Neves (PSG & Portugal)
  • Lamine Yamal (Barcelona & Spain)
  • Kenan Yildiz (Juventus & Turkey)

Women Kopa Trophy nominees

Here na di five nominees for di first-eva Women Kopa Trophy wey go crown di best under-21 women footballer for di world.

  • Michelle Agyemang (Arsenal & England)
  • Linda Caicedo (Real Madrid & Colombia)
  • Wieke Kaptein (Chelsea & Netherlands )
  • Claudia Martinez Ovando (Club Olimpia & Paraguay)
  • Vicky Lopez (Barcelona & Spain)

Yachine Trophy nominees (Men)

Di full list of 2025 Yachine Trophy nominees dey revealed and e include a names from di Premier League.

  • Alisson Becker (Liverpool & Brazil)
  • Yassine Bounou (Al-Hilal & Morocco)
  • Lucas Chevalier (Lille & France)
  • Thibaut Courtois (Real Madrid & Belgium)
  • Gianluigi Donnarumma (PSG & Italy)
  • Emiliano Martinez (Aston Villa & Argentina)
  • Jan Oblak (Atletico Madrid & Slovenia)
  • David Raya (Arsenal & Spain)
  • Matz Sels (Nottingham Forest & Belgium)
  • Yann Sommer (Inter Milan)

Yachine Trophy nominees (Women)

  • Ann-Katrin Berger (Gotham FC & Germany)
  • Cata Coll (Barcelona & Spain)
  • Hannah Hampton (Chelsea & England)
  • Chiamaka Nnadozie (Brighton & Nigeria)
  • Daphne van Domselaar (Arsenal & Netherlands)

Men Team Coach of di Year Trophy nominees

  • Antonio Conte (Napoli)
  • Luis Enrique (Paris St-Germain)
  • Hansi Flick (Barcelona)
  • Enzo Maresca (Chelsea)
  • Arne Slot (Liverpool)

Team Coach of di Year Trophy nominees (Women)

Here na di nominees of Women Team Coach of di Year Trophy:

  • Sonia Bompastor (Chelsea)
  • Arthur Elias (Brazil)
  • Justine Madugu (Nigeria)
  • Renee Slegers (Arsenal)
  • Sarina Wiegman (England)

2025 Men Club of di Year

Here na all di nominees for di 2025 Men Club of di Year

  • FC Barcelona
  • Botafogo
  • Chelsea
  • Liverpool
  • Paris Saint-Germain

2025 Women Club of di Year

Arsenal (England)

Barcelona (Spain)

Chelsea (England)

OL Lyonnes (France)

Orlando Pride (United States)

Men's Ballon d'Or nominees

  • Ousmane Dembele (PSG & France)
  • Gianluigi Donnarumma (PSG & Italy)
  • Jude Bellingham (Real Madrid & England)
  • Desire Doue (PSG & France)
  • Denzel Dumfries (Inter Milan & Netherlands)
  • Serhou Guirassy (Borussia Dortmund & Guinea)
  • Erling Haaland (Man City & Norway)
  • Viktor Gyokeres (Arsenal & Sweden)
  • Achraf Hakimi (PSG & Morocco)
  • Harry Kane (Bayern Munich & England)
  • Khvicha Kvaratskhelia (PSG & Georgia)
  • Robert Lewandowski (Barcelona & Poland)
  • Alexis Mac Allister (Liverpool & Argentina)
  • Lautaro Martinez (Inter Milan & Argentina)
  • Scott McTominay (Napoli & Scotland)
  • Kylian Mbappe (Real Madrid & France)
  • Nuno Mendes (PSG & Portugal)
  • Joao Neves (PSG & Portugal)
  • Pedri (Barcelona & Spain)
  • Cole Palmer (Chelsea & England)
  • Michael Olise (Bayern Munich & France)
  • Raphinha (Barcelona & Brazil)
  • Declan Rice (Arsenal & England)
  • Fabian Ruiz (PSG & Spain)
  • Virgil van Dijk (Liverpool & Netherlands)
  • Vinicius Jr (Real Madrid & Brazil)
  • Mohamed Salah (Liverpool & Egypt)
  • Florian Wirtz (Liverpool & Germany)
  • Vitinha (PSG & Portugal)
  • Lamine Yamal (Barcelona & Spain)