WAEC shut down portal, to review 2025 result ova technical glitch

Students dey write exam

Wia dis foto come from, WAEC/X

Read am in 3 mins

Di West African Examinations Council (WAEC) don announce say dem dey investigate technical issues inside di recently released 2025 West African Senior School Certificate Examination (WASSCE) results.

So therefore, dem don temporarily deny access for candidates to check di 2025 result for dia portal.

Di national examination body for one statement on dia X account tok say during one internal review, one internal post result release procedure reveal some technical bugs for di results.

Dis dey come as di WAEC result checker portal dey shutdown and candidates no fit access dia results.

Waec say sake of di review, dem don decide to urgently review and correct di technical glitches wey lead to di situation, as a result, access to di WASSCE (SC) 2025 results don dey temporarily denied on di result checker portal.

Dem say make pipo wey don check dia result before, make dem come back after 24 hours to re-check.

Waec bin release di 2025 WASSCE result on Monday, 4 August.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Wetin be di technical glitch wey WAEC discover

Di council say as part of efforts to check examination malpractice, dem bin embark on one innovation (paper serialization) wey di national examination body bin already deploy.

Dem carry out di paper serialization in Mathematics, English Language, Biology and Economics, but one internal post result release procedure bin reveal some technical bugs for di results.

Di national examination body say sake of dat, dem don shut down di result checker portal and dey try resolve di mata wit "transparency and urgency" within di next 24 hours.

Na on Monday, 4 August, Waec release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination.

But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years.

Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, bin tok say dis year result record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024.

"Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok.

Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago.

Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination.

According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.