Breakdown of 2025 WASCCE results wey Waec release and why e be di worst in five years

Wia dis foto come from, Pascal Deloche via Getty Images
Di West African Examination Council (Waec) on Monday 4 August release di results of di 2025 West African Senior School Certificate Examination.
But in comparison to previous results, dis na di worst results in five years.
"Di West African Examinations Council dey pleased to inform candidates wey sit WASSCE for School Candidates, 2025 say di result don officially dey released today, Monday, August 4, 2025," Waec write for X.
How many candidates sit for di exam and wetin be di performance?
Na 1,973,365 candidates bin register for di examination from 23,554 recognised secondary schools for Nigeria, but na 1,969,313 candidates bin sit for am, according to Waec.
Out of dis number, na 976,787 candidates be males, while 992,526 be females. Male candidates represent 49.60 per cent while female candidates represent 50.40 per cent.
Candidates wey obtain credit and above for minimum of five subjects including English Language and Maths na 754,545, and dis one representing 38.32 per cent.
Di Head of Nigeria's Office (HNO) of Waec, Amos Dangut, tok say dis year results record 33.8 per cent decrease in performance compared to 72.12 per cent wey dem record for 2024.
E yarn dis one wen im announce di release of di results for one media briefing wey happun for Waec headquarters for Lagos, southwest Nigeria.
"Out of di total number of candidates wey sit for di examination for Nigeria, 1,517,517 candidates, wey represent 77.06 per cent, get dia results fully processed and released while 451,796 candidates, wey represent 22.94 per cent, get one or more of dia subjects still under processing sake of some issues to dey resolved," e tok.
Issue of examination mago-mago
Amos Dangut say Waec don withhold results of 192,089 candidates sake of different reported cases of examination mago-mago.
Dis number represent 9.75 per cent of di total number of candidates wey sit for di examination.
According to Dangut, di figure represent 2.17 per cent decline if you compare am wit di 11.92 per cent wey dem bin record for di 2024 edition of di same examination.
Candidates performance from five years ago
For 2020, na 1,003,668 candidates, wey represent 65.24 per cent out of 1,601,047 wey sit for di exams, obtain credits and above for minimum of five subjects, including English Language and Mathematics, according to Waec.
Improvement dey for 2021 as di examination board record improvement of 81.7 per cent pass rate, wey translate to 16 per cent.
E reduce to 76.36 per cent for 2022, and dis one represent more dan 5 per cent decline in performance.
For 2023, di examination body bin record 79.81 per cent pass rate including dose wey make English and Mathematics papers.
Di pass rate bin reduce to 72.12 for 2024.
Wetin be di cause of dis performance?
Nigerian educationist Dr Harmony Mark-Ewa wey follow BBC News Pidgin tok say according to her thesis, di reason na say di partnership between di home and di school dey low.
Di thesis wey she title Management of Home-school Partnership and Attainment of Sustainable Development Goal 4 (Quality Education) in Public Senior Secondary Schools in Rivers State, shed light on di issues wey students dey face.
"Veri low communication gap dey between di home and di school regarding di attainment of quality education," Dr Mark-Ewa tell BBC News Pidgin.
She say parents fit no dey follow up wit di discipline wey teachers dey give students for school, and e fit also be di oda way round.
On home-school discipline, Mark-Ewa say discipline start from home and e dey reinforced for school. She say e also start from school and e dey reinforced for home.
Dr Mark-Ewa say parents dey sometimes distract dia children wit errands wen dem dey busy wit di exercise wey dem give dem for school.
On environment, she say: "Di environments for dia school and di ones dem dey return to wen dem comot for school, how dis environments be?"
She say environment na veri strong factor to achieve academic success.
Dr Mark-Ewa say for students to begin do well for school, parents and teachers gatz ensure say dem work collaboratively.
"Parents and schools gatz relate more in training and developing di pikin," she tok.
How to check Waec result?
To check your Waec result, visit www.waecdirect.org and log in.
You go need Waec scratch card to check your result.
Login to WAEC Result Checker Website www.waecdirect.org.
Enter your Examination Number
Select Examination Type e.g May/June
Select Exams Year e.g 2025
Click on Check Result.








