Wetin we know as police detain activist Omoyele Sowore

Wia dis foto come from, Omoyele Sowore
- Author, Andrew Gift
- Role, Reporter
- Read am in 4 mins
Police for Nigeria don detain former presidential candidate and human rights activist Omoyele Sowore.
Di activist bin go honour one police invitation on Wednesday but no comot from di police station at di end of di day.
Im lawyer Marshal Abubakar tell BBC News Pidgin say dem sama am allegation of criminal defamation and forgery of police document.
According to am, police show dem two petitions against Sowore, say one of di petitions, na police write am.
E say dem dey give di authorities 24 hours to release Sowore or dem go enta court to go resolve di mata.
Police authorities never respond to BBC News Pidgin requests. Police tok tok pesin Muyiwa Adejobi no pick im calls nor respond to messages wey we send to im phone.
Videos wey trend on social media on Tuesday show wia Sowore wit im lawyer and supporters dey waka go police station for Abuja.
E carry bag and claim say wetin dey inside na im personal effects like soap, toothbrush and clothes incase dem decide to detain am.
Meanwhile Amnesty International don call for di immediate release of di activist.
For inside statement, dem condemn di arrest and detention of Sowore and demand make di authorities release am and drop all "bogus and politically motivated allegations" against am.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, Sowore
Sowore political party African Action Congress AAC describe di arrest and detention as attack on democracy and abuse of power by di authorities.
Dem dey call for mass protest across Nigeria until dem release Sowore.
Oda groups wey don chook mouth for di matter include Coalition of United Political Parties CUPP and Arewa youths.
For separate statements on Thursday, dem describe di detention as infringement of di activist fundamental human rights wey di Nigeria constitution dey protect.
According to dem, Nigeria Police don turn to weapon wey oppressors dey use oppress dia enemies.
Di Arewa Youths say dem dey give di authorities 72 hours to release di activist or dem go begin protests across di 19 northern states of Nigeria.
Some of Sowore supporters bin stage brief protest in front of di police station wia dem detain am yesterday.
One of im lawyers notify BBC say by 6:00am Thursday morning, dem sight Sowore as a team of police officers whisk am away from di cell wia im bin dey, carry am go SARS office.
Who be Sowore
Omoyele Sowore na journalist, human rights activist wey bin don follow contest for Nigeria presidential election.
E don collect plenti arrest and detention over di years.
Im be di RevolutionNow leader for Nigeria and Publisher of Sahara Reporters news platform.
Nigeria govment bin arrest Sowore for August 2, 2019 say im commit treason.
Dem later release am for 5 December afta e spend more dan 3 months for detention, only to re-arrest am inside court less dan 12 hours later.
On 13 December, 2019, Attorney General of Nigeria and Minister of Justice, Abubakar Malami bin take ova di case of Sowore from di country Department of State Service.
Den on December 24, DSS release di publisher afta oga Malami write to di DSS say make dem release am.










