Former Super Eagles captain and coach Christian Chukwu don die at di age of 74

Wia dis foto come from, Getty Images
Former Super Eagles captain and head coach Christian Chukwu don die at di age of 74 on Saturday 12 April.
Di Nigeria Football Federation (NFF) announce dis informate on Saturday.
"Di Nigeria Football Federation don express deep sorrow afta e dey confirmed say Christian Chukwuemeka Chukwu, wey bin captain Nigeria 1980 Africa Cup of Nations-winning squad and later coach di team, bin die for im native city of Enugu on Saturday.
Im be di first Nigerian captain to lift di African Nations Cup trophy afta a 3-0 victory over Algeria for di final of di 1980 tournament for Lagos.
Di Enugu-born legend bin also lead di Super Eagles to a third-place finish at di 2004 Africa Cup of Nations for Tunisia.
"We don lose a good and great man. Chukwu na di definition of a strong, dedicated and disciplined leader on and off di field," General Secretary of NFF, Dr Mohammed Sanusi, tok.
E say dem no dey call am Chairman for notin, as im be di definition of strength, vison and consistency.
"We pray say di Almighty go grant im soul eternal rest, and also grant di family and friends wey im leave behind, Nigeria football fraternity, di fortitude to bear dis big loss."
End of Di one wey oda users dey read well well
Chukwu long-time friend and team mate Segun Odegbami also confam im death as e mourn Chairman.
"I just receive di news say between 9:00 and 10:00 dis morning, 'Chairman' Christian Chukwu, MFR, my bosom friend and team mate, one of di greatest football players for Nigeria football history, former captain and coach of Nigeria national football team, don pass on.
"Babuje, Emmanuel Okala, MON, bin give me di sad news a few minutes ago! May 'Onyim' find peace wit Our Creator for Heaven, and console im family.
Mallam Shehu Dikko wey be di National Sports Commission (NSC) Chairman also mourn di death of di legendary former player and coach.
"Dis news bin come to me as big shock. Chairman no dey again. On behalf of di Commission and di entire sporting fraternity and indeed di Federal Goment of Nigeria, I extend my condolences to im family and indeed di whole of Nigeria. Frankly, a big iroko tree don fall.
"We be di Chairmen wey dey lead di sector but Christian Chukwu na di original Chairman on di pitch. Im bin dey so commanding and charismatic, decisive and assuring on di pitch sotey Late Ernest Okonkwo bin call am chairman and till today dat name Chairman even dey more popular dan im original name," Dikko tok.
Who be Christian Chukwu
Dem born Christian Chuwku for 4 January 1951.
Chukwu bin dey di Nigeria senior team wey win bronze medals for di 1976 and 1978 Afcon finals for Ethiopia and Ghana respectively, bifor im lead di squad to glory on home soil for 1980. Dem bin name am Player of di Tournament.
Chukwu bin coach im darling club, Enugu Rangers (e bin play for only one club for im career) and den coach di senior national team of Kenya.
Dem name am Head Coach of di Super Eagles for 2002, and im lead di team to finish third for di 2004 Afcon finals for Tunisia.















