All you need sabi about US Embassy new directives for Nigerian visa applicants

Close up of American visa label in passport

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

Di United States Embassy for Nigeria don announce say all visa applicants for Lagos and Abuja go need to carry DS-160 visa application form wey get confirmation/barcode number wey match di one wey dem take make di application online.

For statement wey dem bin release on Friday 11 April, di Embassy reveal say di number go start wit AA and den 00.

Di new requirements also ask make applicants make dia appointment for di location wey dem select wen dem dey fill dia DS-160.

E mean say from 22 April, if di barcode numbers no match, dem no go gree make you enta di Consular section or attend di visa interview.

Di US Embassy also torchlight how to correct am if di barcode number no dey di same.

"You gatz log into your AVITS account at least 10 days bifor your appointment to create support ticket wey go request for correction of your barcode number."

But if dem drive you comot becos of dis wahala, US Embassy say you fit correct di barcode wahala come book for new visa appointment, although you go pay again if your visa fee don expire bifor dat time.

Dis informate dey drop about four months afta di United States Mission for Nigeria bin drop new visa application process for pipo wey wan japa dia.

Wetin be di process to get visa to US for Nigerians

Di mission say applicants go need to visit di consulate two times during di application process.

Di mission explain say di first visit to di U.S. Consulate for Lagos na for In-Person Document Review wit one consular staff member to ensure say di applicant dey prepared for dia visa interview.

Dem say dis compulsory review go give di applicant opportunity to get any missing documents ahead of im visa interview to avoid delays for di application process.

"You no need to schedule appointment for di In-Person Document Review. Di Consular Section go notify you through email of di document review appointment date wey go be approximately two to four weeks ahead of your visa interview".

Di second visit na for di Visa Interview wit a Consular Officer.

Di visa interview go hold on di date and time wey di National Visa Center (NVC) schedule am for. If you no complete di In-Person Document Review bifor your visa interview, you go dey required to reschedule your appointment, according to di Mission statement.

Applicants gatz also bring different documents come di In-Person Document wey include valid passports, birth certificates, medical records plus police certificates for applicants ova di age of 16.

Oda steps to prepare for di immigrant visa interview according to di statement from di Mission na to create online account, do a medical exam for Nigeria, complete di pre-interview checklist and document pickup for Lagos or Abuja.