Wetin law tok about indecent dressing wey Delta police say dem wan begin collect 50,000 naira for

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Delta State Police Command on Saturday say di state don ready to dey punish anybodi wey no dress well wit section 16 of di state Violence Against Persons Law (VAP), 2020.
For dia X handle, di state police command post one image wey include one woman wey wear tank top and miniskirt wit di caption: "As you nor like wear cloth wey dey cover your body well, and you prefer dey waka go work, school or anywhere with clothes wey dey show everywhere for your body, make you hear am – Delta State government nor dey smile for that kain dressing.
"VAAP law don ready to punish anybody wey nor dress well. Punishment: Community service or N50,000 fine."
Di mata cause tok-tok among some Nigerians wey see am as violation of dia human right, while odas hail am.
BBC News Pidgin check out di VAP law wey di state police command quote to chook eye for di mata.
Our finding show say na Economic Abuse dey di section 16 wey di state police command quote.
Di four subsections read:
- Pesin wey cause economic abuse to anoda commit offence and dey liable on conviction to a term of 3 years imprisonment or to a fine not exceeding N500,000.00 or both.
- Pesin wey attempt to commit di offence wey dey provided for in subsection (1) of dis Section, commit offence and dey liable on conviction to a term of 1 year and 6 months imprisonment or to a fine wey no exceed N200,000.00 or both.
- Pesin wey incite, aids, abet, or procure anoda pesin to commit di offence provided for in subsection (1) of dis Section dey deemed to don take part in committing di offence and dey liable on conviction to di punishment prescribed for subsection (1).
- Pesin wey receive anoda, unless for di purpose of handing im or her over to security agents, or assists im or her knowing say e or she commit di offence wey dey provided for in subsection (1) of dis Section, na accessory afta di fact and e dey liable on conviction to a term of 1 year and 6 months imprisonment or to a fine wey no go exceed N200,000.00 or both.
Section 16 no mention anytin about indecent dressing.
End of Di one wey oda users dey read well well
Indecent Exposure
Notin like indecent dressing inside di VAP law, but section 29 wey dem title Indecent Exposure tok about di punishment wey pesin wey intentionally expose im private part for public go get.
Di section read:
- Pesin wey intentionally expose any of im or her private parts wholly or partly for public commit di offence of indecent exposure.
- Pesin wey commit di offence provided for in subsection (1) of dis Section dey liable on conviction to perform such community service as di court fit order or to pay a fine wey no exceed N50,000.00 or both.
Di punishment wey dey inside dis section na im di Delta State Police Command bin quote for dia statement.














