Nigerian brodas chop jail sentence for US over sextortion wey make Jordan DeMay kill im sef

Di face of di two brodas wey chop jail term.

Wia dis foto come from, EFCC/Facebook

Read am in 7 mins

Two Nigerian brodas Samuel and Samson Ogoshi wey target one17-year-old boy for one sextortion scam don chop jail sentencing for di US.

US District Judge Robert J. Jonker wey deliver di judgement find di boys guilty of di offence afta dem appear for Marquette Federal Courthouse.

Di two brodas dey sentenced to 210 months (17 and half years) for jail. Dem go serve term for di federal prison.

Di Ogoshi brodas bin deceive Jordan DeMay to send dem sexual images as dem pretend to be girl wey dey same age wit am.

Dem blackmail di boy and e kill imself less dan six hours, afta dem begin dey tok for social media.

Jordan DeMay na 17 years old popular athletic schoolboy from Michigan.

DeMay die for 2022 wen di boys begin dey blackmail am for social media.

Jordan mama, Jenn Buta hold pictures of her son for court and she cry as she read one victim impact statement. "I dey shattered to my core," she tok.

She welcome di end of di trial, but tok say no beta outcome from di tragic case.

Di two Nigerian brodas Samuel and Samson Ogoshi and one Ezekiel Robert bin face four count charges wey involve sexual extortion.

U.S. Attorney for di Western District of Michigan Mark Totten bin open di case of di three Nigerian men wey dem charge wit sexually extorting numerous young men and teenage boys for di district and across di United States.

One of dem wey be Samuel Ogoshi chop serious charges sake of say e cause di death of one young boy Jordan DeMay.

Dis go be di first successful prosecution of Nigerians for sextortion for America, wia cyber-crime wey often dey linked to Nigeria dey grow rapidly.

For March 25, 2022, dem find di deadi bodi of 17-year-old DeMay afta some 'self-inflicted gunshot wound'.

Na im death start di investigation by di Marquette County Sheriff Department and di Federal Bureau of Investigation (FBI).

For April 2024, di two Ogoshi brodas bin plead guilty to di charges of sexually exploiting teenage boys across di US.

Authorities bin also identify 38 oda American victims wey di men dey target. 13 out of dem be minors.

Di brothers siddon for court, dem wear orange jumpsuits wit handcuffs on dia hands.

Dia defence attorneys say na drug abuse ginger di brothers to commit di crime plus di sextortion scam culture for Nigeria.

Di judge tok say di crimes show "callous disregard for life", especially as dem continue dey target oda victims even afta dem know say Jordan don die.

Both brothers don tok sorry to Jordan family.

Samson Ogoshi tell di family say im dey sorry "We make bad decision to make money and I wish I fit change am," Samson Ogoshi tok.

Na di first case of im kind, US police bin track di criminals go Lagos last summer and successfully extradite dem for trial.

According to di US Attorney office, di charges against Robert bin dey pend unless proven guilty beyond a reasonable doubt for court of law.

Meanwhile, for 17 August, di Ogoshi broda later plead not guilty during dia arraignment afta dem formally advise dem ontop di charges against dem.

Afta di death of DeMay, im mama, Jenn Buta, dey use im TikTok account to warn young pipo about dat kind criminals, many of dem base for Nigeria.

How dem cause death of 17 years old boy

Picture of Jordan wit im mama
Wetin we call dis foto, 17-year-old Jordan DeMay kill imself afta di two brodas target am

Di two Nigerian brothers, Samuel Ogoshi wey be 24-year-old and Samson Ogoshi, 21-year-old bin send 17 year-old Jordan DeMay friend request on Instagram and dem pretend to be fine girl wey dey di same age wit am and dem flirt wit am.

Once dem get sexual images from di teenager, dem begin blackmail am for hundreds of dollars, dem threaten to share fotos online wit im friends if e no send dem di money.

Jordan bin send all di money e fit gada and warn di scammers say im go kill imself if dem share di fotos.

Di criminals bin reply: “Good… Do am fast - or I go make you do am.”

John DeMay bin tell di Marquette federal court for Michigansay im still dey get nightmares afta e find im son deadi-body for im bedroom. He say im family dey forced to move home to escape di memory.

Di charges against di defendants and punishment

Di four count charges wey dem sama di three accused defendants according to di U.S. Attorney office include:

Count 1 bin charge Samuel Ogoshi wit sexual exploitation and attempted sexual exploitation of a minor wey result for death in association wit di death of Jordan DeMay.

Count 2 bin charge all three men wit conspiracy to sexually exploit minors by causing di minors to produce child pornographic images wey dem go den use to blackmail di minors.

Count 3 bin charge all di three men wit conspiracy to distribute child pornography, for sending di child pornography images to di minors, as well as dia families and friends.

Count 4 charge na conspiracy to commit stalking through di Internet for engaging for dis sextortion scheme as e dey relate to both minors and young adults.

Some of di charge dey carry a maximum penalty of life in prison and a mandatory minimum of 30 years for prison.

Oda cases authorities dey torchlight

Two blurred Nigerian men

Wia dis foto come from, NSW Police

Wetin we call dis foto, Australian police bin release blurred foto of two accused sextortionists

Researchers and law enforcement agencies don point to Nigeria as hotspot for dis type of crime.

For April, dem arrest two Nigerian men afta one schoolboy from Australia kill mself.

Two oda men also dey on trial for Lagos afta di suicides of one 15-year-old boy for US and one 14-year-old for Canada.

Nigerian authorities dey work wit police for Scotland to investigate di case of 16-year-old Murray Dowey, wey kill imself for December 2023.

For January, US cyber-company Network Contagion Research Institute (NCRI) bin torchlight one web of Nigerian TikTok, YouTube and Scribd accounts wey dey share tips and scripts for sextortion.

Many of di discussions and videos dey in Nigerian Pidgin dialect.

Nigeria cyber-security professor Adedeji Oyenuga from Lagos State University say im hope say news say dem dey sentence Nigerians go jail go scare di criminals and make dem stop.

Dis no be di first time wey some Nigeria young, tech-savvy population don embrace dis new wave of cyber-crime.

Dem dey use di term "Yahoo Boys" describe a portion of di population wey dey use cyber-crime earn living.

E start for di early 2000s wave of Nigerian Prince scam emails wey spread through di Yahoo email service.

Dr Tombari Sibe, from cyber-security firm Digital Footprints Nigeria, say cyber-fraud like sextortion don become normal thing among young pipo for di kontri, but e hope say di news of di Ogoshis' sentencing go spread fast.

How you fit handle sextortionist

Advice wey Jenn Buta and many law-enforcement agencies dey regularly give pipo wey sextortionists dey target include:

  • Remember say you no dey alone and dis no be your fault
  • Report di predator account, via di platform safety feature
  • Block di predator so dem no go fit contact you
  • Save di profile or messages - dem fit help law enforcement identify and stop di predator
  • Ask for help from a trusted adult or law enforcement before sending money or more fotos
  • To cooperate wit di predator no fit stop di blackmail and harassment - but law enforcement fit

Tips to avoid falling victim of sextortion

Sabi pipo recommend some tip wey pipo gatz note so dem no go become victim of sextortion.

Di cyber security authority for Ghana bin give some tips wey go make pesin sabi say dis tin na scam or blackmail.

  • Avoid to dey accept online friend requests from unknown pipo (especially dose wey get questionable profile information)
  • Dey careful of such social media friendships wey di pipo go tok say make una carry di relationship enta WhatsApp
  • No capture or store your nude pictures and videos for your phone
  • Beware of video calls from unknown pipo on top social media platforms
  • No share nude pictures and videos via social media platforms (weda inside private inbox or not)
  • Dey careful of unsolicited messages or offers especially di ones wey dey promise business opportunities or money