Nigerian court send man to 76 years in prison for internet fraud wey lead to death of Canadian teenager

A collage of Olukeye Adedayo and Rob Janjua

Wia dis foto come from, EFCC/Benoit Ferradini/Radio Canada

Read am in 4 mins

One Federal High Court for Ikoyi, Lagos, southwest Nigeria don sentence one Olukeye Adedayo to 76 years for prison for internet fraud wey involve child pornography, sextortion, and impersonation.

Justice Alexander Owoeye deliver di judgment on Thursday, 19 June 2025, as e convict Adedayo on all 18 counts wey di Lagos Zonal Directorate 2 of di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) bring against am.

Di charges, wey dem file for 2024, na on transmission of child pornography, fraudulent impersonation, and sextortion wey amount to ₦721,500.

Adedayo, wey bin dey operate under aliases including hrm87, charlotte708, and harlilott_716, chop accuse of creating one group on Instagram titled "Expose Janjua Robin Nudes" to distribute explicit images of one 14-year-old Canadian boy identified as Robin Janjua.

Im bin plead not guilty to di charges against am, but di prosecution, led by Bilikisu Buhari, bin call two key witnesses: Wahid Hamidi of di Royal Canadian Mounted Police (RCMP) and EFCC operative Saidu Yakubu. Dem also present for court substantial digital and documentary evidence.

Justice Owoeye sentence Adedayo to two years each on counts 1 to 4 of procuring, distributing of child pornography and cyberstalking; four years imprisonment on counts five to 14 of retention and disguising di origin of proceeds of fraud, witout option of fine; seven years imprisonment on counts 15 to 18 of obtaining property under false pretences, witout option of fine.

Brief background

For February 2023, dem call police to one residence for Surrey, British Columbia, sake of report of sudden death wey involve one teenage boy.

Police say dem quickly determine di 14-year-old na target of sextortion, wey scammer trick say make e send im explicit fotos.

Olukeye Adedayo bin tell di boy to buy gift cards so im no go distribute di images online, RCMP tok.

"Im bin love hockey and e bin love life. No day wey we no dey miss am. Na innocent child wey dem take advantage of sake of im innocence," im family tok.

Di Lagos Zonal Command of EFCC on Friday 29 September 2023, arraign Olukeye Adedayo.

Dem request for accelerated hearing of di mata and add say "di international image of Nigeria dey in jeopardy, as both di Royal Canadian Mounted Police (RCMP) and di FBI bin complain to Nigeria about dis mata and how e relate to di sudden death of one 14-year-old minor ".

Na on Friday 4 August 2023 EFCC gbab Adedayo for di Akute area of Ogun State, southwest Nigeria, afta dem receive information from RCMP.

During a search wey EFCC conduct om im residence for Ilaro, Ogun State, dem recover one mobile fone wey get documents of im crime.

Dis no be di first time wey court go dey send Nigerian fraudster to prison sake of dis kain crime.

For 2024, two Nigerian brodas Samuel and Samson Ogoshi wey bin target one17-year-old boy for one sextortion scam bin chop jail sentencing for di US.

US District Judge Robert J. Jonker wey deliver di judgement find di boys guilty of di offence afta dem appear for Marquette Federal Courthouse.

Di court sentence di two brodas to 210 months (17 and half years) for jail.

Tips to avoid falling victim of sextortion

Sabi pipo bin dey recommend some tip wey pipo gatz note so dem no go become victims of sextortion.

Cyber Security Authority for Ghana give some tips wey go make pesin sabi say dis tin na scam or blackmail.

  • Avoid to dey accept online friend requests from unknown pipo (especially dose wey get questionable profile information).
  • Dey careful of such social media friendships wey di pipo go tok say make una carry di relationship enta WhatsApp.
  • No capture or store your nude pictures and videos for your phone.
  • Beware of video calls from unknown pipo on top social media platforms.
  • No share nude pictures and videos via social media platforms (weda inside private inbox or not).
  • Dey careful of unsolicited messages or offers especially di ones wey dey promise business opportunities or money.