Police arrest school principal wey allegedly defile four year old girl with scissors

Pikin siddon

Wia dis foto come from, AFP

Police for Delta State don arrest one school principal wey allegedly defile a 4-year-old pupil.

Tok tok pesin for Delta State Police Command SP Bright Edafe confam to BBC Pidgin say di suspect dey dia custody and dem go soon charge am go court as soon as dem finish dia investigation.

According to police, di suspect, na principal of one school for Agbor, Delta State, and e chop accuse say e use a pair of scissors to tear di small pikin hymen for her private part to allow am penetrate her.

Wen di pikin reach house, she complain of pains to her mama and wen her mama check, she notice blood around her genitals and wen she ask her wetin happen to her she say na di principal na im carry her go inside toilet chook her injection for her bum-bum and use di scissors on her.

Di mama report di mata to police wey go arrest di principal of di school.

Mama of di girl add say she dey under pressure to settle di matter privately but she say she no gree and she wants Justice for her daughter.

In di last few weeks, several reports of alleged defilement don dey reported to di authorities across Nigeria.

For Rivers state, di Human Rights Desk of of di Police Command arrest one 42 year old man for allegedly defiling im 13-year-old house maid for Eneka, Obio-Akpor LGA of Rivers State.

Na on Monday 16 October 2023 di Human Rights Desk arrest di suspect wey be papa of three children after some concerned neighbours report di mata to dem.

Tori be say di suspect na rig worker wey no dey usually around, but wen im dey town and im wife no dey around, im dey go by-force di di housemaid wey dey stay with dem.

Dis time around wen im approach her, di girl run comot from di compound and report to some neighbours wetin she dey go through.

Similarly, operatives of Nigeria Security and Civil Defence Corps, Jigawa State Command arrest one 56 year old man for Unguwar Mani Quarters, Roni Local Goment, Jigawa State on accuse say e allegedly defile a 14-year-girl.

For statement wey tok tok pesin of di Comman CSC Adamu Shehu sign, dem arrest di suspect on Wednesday, 4th of October, 2023 following complain by di victim brother wey report say di suspect bin don rape and impregnate im 14 year old sister wey be house help for di suspect house and e dey pressure di family to abort di pregnancy.

Medical examination for Sexual Assaults and Referral Centre (SARC) reveal say di victim dey pregnant for about four months two weeks.

Di NSCDC don charge di suspect to court, while investigation still dey go on for di oda allegations against di two oda pesins to ascertain dia level of involvement in di case.