Court dismiss no case submission Osinachi husband bin file based on autopsy result

Wia dis foto come from, PETER NWACHUKWU
Justice Njideka Nwosu-Iheme for one Abuja High Court don dismiss di no-case submission wey Peter Nwachukwu bin file as e dey face accuse for di death of im wife, gospel singer, Osinachi Nwachukwu.
According to tori pipo Channels, Justice Nwosu-Iheme tok for di ruling say di prosecution bin already establish case against oga Nwachuku.
E bin plead not guilty to di 23 count charge wey federal goment bin file against am on top di death of Osinachi.
Di judge bin order say im go stay for inside di Kuje correctional facility until further hearing.
Di prosecution bin call 17 witnesses to testify for trial wey start for June 20, 2022 and end for March 10, 2023.
Mrs Osinachi bin die on April 8, 2022 and reports bin to say she get throat cancer.
But family and friends comot to tok say her death dey linked to domestic violence by her husband and police later arrest am.
Di National Hospital for Abuja bin do autopsy wia dem no find any sign of violence for di bodi,.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di report tok say wetin cause Osinachi death na "generalised organ pallor, bilateral leg swelling, water for di sac wia di heart dey, tumor deposits in and on di heart, lung, kidneys, massively enlarged heart, and fluid around di lungs wey go restrict breathing".

Wia dis foto come from, OTHER
Na sake of di autopsy report di lawyer wey dey represent Oga Nwachukwu bin file no-case submission give di court say im no get case to ansa.
Di lawyer say di autopsy report bin free oga Nwachukwu from di allegation of culpable homicide and domestic violence.
E say di report confam say Osinachi die "only because of di outgrowth tumours, wey cause cardiac tamponade wey be di primary cause of death and abnormal growth of tissue, wey be cancer wey be di secondary cause of death".
E ask di court make dem discharge and acquit im client of all charged.
But di court no gree and order di defendant make im open im defence.













