Five key talking points from Trump and Ramaphosa meeting wey happun for US

Wetin we call dis Video, Watch moment Trump ambush Ramaphosa wit video
Read am in 4 mins

US President Donald Trump and South African President Cyril Ramaphosa bin follow tori pipo tok for Oval Office on Wednesday 21 May.

Dis meeting dey come afta Ramaphosa bin call di group of 59 white South Africans wey gree to be refugees for US, cowards.

Trump say white farmers dey "run from South Africa".

Di US president and im padi, South African born Elon Musk, don tok bifor say "genocide" of white farmers dey go on for im kontri of birth. Dis na claim wey dey widely discredited.

Trade also dey part of wetin dem tok about as South Africa bin gbab 30% tariffs from di US.

Part of di tins wey dem tok about na di G20 summit wey go dey hosted for South Africa for di first time bifor di US become di leader for di next year.

Dis na five key talking points from di meeting:

1. White South African refugees

Trump ansa questions on iwhite South African mata say, "we bin hear ogbonge complain about Africa" say white farmers, dey "run from South Africa".

Ramaphosa no gree say white South Africans dey persecuted but den Trump confront am wit video and kon show am pictures of news stories. Di stories and pictures claim say dem kill white farmers for South Africa.

But Ramaphosa say e no gree and add say no be goment policy.

Trump adviser Billionaire Elon Musk also join di meeting wit di South African leader even though im no tok.

Musk sef na South African wey dey usually promote discredited stories about "genocide" against white South Africans but e no chook mouth for dis meeting.

Trump say e no wan include Musk for di debate about discrimination against white South Africans, and say "I no think e dey fair to (Musk)".

2. Ukraine war

President Trump chook mouth for di Ukraine-Russia war for wetin e call di "bloodbath" of Ukraine.

"Na bad situation", Trump tok even as e add say e hear say Ukrainian President Volodymyr Zelensky go South Africa.

Ramaphosa tok say "we go like to see di end of dat war" as e tell Trump say e support di work wey e dey do to try end di war.

3. ICC case against Israel

Trump tok say e no expect anytim to comot from di International Criminal Court (ICC) case against Israel.

Na tori pesin ask dis one as di ICC dey investigate Israel for alleged war crimes for Gaza.

E add say, "plenti anger dey dia, ogbonge anger".

E follow am wit, "we go get ruling, who know wetin di ruling go mean".

Trade

Ramaphosa bin find way to drag di tok-tok between di two leaders go back to trade.

Di South African president start to tok about one technology partnership between di US and South Africa.

E say e wan sidon and get beta tok-tok about wetin fit bring beta results.

Pesin from Ramaphosa Delegation, Zingiswa Losi, wey be di president of di Congress of South African Trade Union, say thousands of jobs go disappear if US companies comot from South Africa, and add say make US continue to dey invest.

5. G20 Summit

Dem ask Trump weda e go go di G20 summit wey go hold for South Africa later dis year for di first time.

Trump tok say without di US, di G20 "no dey very important".

Ramaphosa say di US na im start di G20 and e dey important say US "continue to play ogbonge role".

US go take leadership of di group next year, and Ramaphosa tok say South Africa dey happy to hand am ova to US di originators.

"I expect US to continue to play dia leadership role for di G20," Ramaphosa add.