World leaders New Year 2025 messages

Wia dis foto come from, Getty Images, X/@WilliamsRuto/@officialBAT/@CyrilRamaphosa
Pipo all ova di world bin usher in di year 2025 wit plenti joy and fireworks evriwia as di celebration for di new year bin sweet pipo.
Howeva, as citizens of different kontris dey celebrate di new year, presidents and world leaders don begin send dia messages and extend greetings.
Some of di world leaders bin send dia message through dia social media pages, while some bin do live broadcast, odas tok dia messages for di new year service.
From Pope Francis message to US president Joe Biden to Cyril Ramaphosa of South Africa to Williams Ruto of Kenya and Bola Tinubu of Nigeria wit oda ogbonge pipo.
World leaders and presidents drop dia messages
- Nigeria
Nigeria President Bola Tinubu don wish Nigerians happy new year wit promise to address high cost of drugs, food and odas.
For im new year message wia e pray make kontri pipo dey rich in joy, success, and good health, Tinubu acknowledge say 2024 na one tough year.
E promise to lower inflation from 34.6% to 15% and make sure say food cost also reduce.
Tinubu add say di federal govment go establish one National Credit Guarantee Company wey go increase access to credit for pipo and critical sectors of di economy to boost national economy.
Di president add say Nigerians also get a role to play.
"To achieve our national goals and objectives, we must become better citizens and uncompromising in our devotion and allegiance to Nigeria.
"Citizens moral rectitude and faith in our kontri dey fundamental to di success of di Renewed Hope Agenda," di president tok.
Tinubu say e go unveil di national Values Charter, wey don already dey approved by di Federal Executive Council, for di first quarter of 2025.
Di Youth Confab go also begin for di first quarter of 2025.
- Kenya
Kenyan President William Ruto don also send New year message give im citizens as dem enta 2025.
Ruto say im thank di pipo of Kenya as dem trust im leadership to deliver good results.
President Ruto bin deliver di New Year message for di Kisii State Lodge, Kisii County, Kenya.
"We celebrate Kenyans say dem trust our leadership wit di transformation of our kontri. We dey glad say dis don take tangible shape and deliver results."
"Through our collective labour, we go work harder and deliver greater progress."
Dis na di message of President Ruto to im Kenyan pipo as dem welcome di year 2025.
South Africa
President Cyril Ramaphosa of South Africa say last year na year of change and progress but im administration go do more to overcome challenges.
Ramaphosa say im thank health workers and all di frontline personnel wey dey respond to di need of di pipo.
Im add say e go work wit law enforcement authorities to ensure say di children for di kontri dey safe and go also ensure better quality education.
"As much as we get progress, we get much more to overcome di challenges wey dey confront our nation."
"We need to work wit urgency and purpose to grow inclusive economy and create jobs."
President Ramaphosa say dem go host di first G20 summit for di African soil and e want make evri South African be part of am.
"Through our leadership of di G20 we go work for solidarity, equality and sustainable development wey go get impact on many pipo around di world."
Di president tok for im new year message say "evri South African go be part of di journey towards a better future for all".
- Pope Francis
Pope Francis say make pipo embrace peace as dem enta di new year.
Di Pope say pipo gatz learn from Mother Mary so dem go fit experience greatness of God for di little wey dem dey do.
"Make we learn to care for di precious gift of life: life wey dey womb, di lives of children, di lives of di suffering, di poor, di elderly, di lonely, and di dying."
Pope Francis also dey grateful for pipo wey dey for places wia conflict dey as dem dey find peace.
"I express my grateful appreciation to all dose for di many areas of conflict wey dey work for dialogue and negotiations."
"Let us pray say di fighting go end on evri front, and decision go dey for peace and reconciliation," Pope Francis tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5