In fotos: How kontris across di world cross ova to 2025

Fireworks

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 4 mins

Some kontris around di world don dey enta di new year wit plenti joy, happiness and some fireworks.

Some ogbonge firework displays don show for major cities as dem ring into di new year.

All ova di world, dem go usher in di new year 2025 but na different time zones evri kontri go enta dia own.

For Nigeria, 31 December na wen plenti pipo dey enta church pass. afta dem shout 'Happy New Year', di struggle continue for anoda year again.

If you dey really look forward to celebrate di end of 2024, here na few key times to watch:

Kiritimati atoll in Kiribati - 10:00 GMT

New Zealand - 11:00 GMT

Most of Australia east coast - 13:00 GMT

Japan and South Korea - 15:00 GMT

India and Sri Lanka - 18:30 GMT

Di UK and 25 oda kontris- 00:00 GMT

Brazil and Argentina 03:00 GMT

Di east coast of di US 05:00 GMT

By di time Baker Island for di central Pacific Ocean comot 2024, e go be 12:00 GMT - by which point e go alreadi be 2 January 2025 for Kiribati.

2025

Wia dis foto come from, Getty Images

First nation officially enta 2025

Di island nation of Kiribati for Oceania na di first kontri for di world to enta di new year.

Kiribati dey occupy a vast area for di equatorial Pacific Ocean, wey stretch nearly 4,000km (2,485 miles) from east to west and more dan 2,000km from north to south.

Di clock just sound for midnight in New Zealand and Auckland dey mark di arrival of 2025 wit di traditional fireworks display for di city iconic Sky Tower.

Di North and South islands lie for di same time zone but di Chatham Islands - some 1,088km (676 miles) east of di South Island - dey 45 minutes ahead and don alreadi kick off celebrations.

Midnight don reach for Sydney, alongside most of eastern Australia, as dem mark di start of 2025.

Di city dey celebrate wit a spectacular fireworks display ova di Sydney Harbour Bridge.

Fotos across di world as dem celebrate new year

We bring you some images of di fireworks display ova Auckland.

Na di world first major city to welcome 2025.

Australia Northern Territory - including Darwin, Alice Springs and Tennant Creek – don also enta 2025.

Both South and North Korea enta 2025 at 15:00 GMT. Although, di Seoul Metropolitan govnment say dia annual bell-ringing show go dey silent sake of di 179 pipo wey die wen Jeju Air Boeing 737 crash landed on 29 December.

Sydney, Taiwan, Hong Kong don also welcome 2025

New Year

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, New Zealand don enta new year
New year

Wia dis foto come from, Getty Images

Fotos from oda kontris

New Year for di streets of Sisli district in Istanbul, Turkiye

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo pose for photographs wit di lights and decorations installed for di New Year for Sisli district in Istanbul, Turkiye
Lights for di street of Istanbul

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo pose for photographs wit di lights and decorations installed for di New Year for Sisli district in Istanbul, Turkiye
Parade for Suzhou Amusement Land Forest World

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Parade for Suzhou Amusement Land Forest World to greet Chinese New Year 2025
A man shopping for item in China

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo dey shop for 2025 New Year ornaments for Nanjing, China
Fireworks in Sydney

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fireworks light up di midnight sky over Sydney Harbour Bridge
Fireworks in Sydney

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Fireworks light up di midnight sky over Sydney during 2025 New Year Day celebrations
A lady holding phone wit anoda man for front

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo attend a New Year Eve countdown celebration, as Taiwan dey welcome di year 2025
Pipo attend a 2025 New Year party on di eve for Taiwan

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Pipo attend 2025 New Year party on di eve for Taiwan