Public holidays and oda days of observance in Nigeria for 2025

Nigerians dey perform during public holiday

Wia dis foto come from, Getty Images

Read am in 3 mins

We don enta di new year 2025 and many days dey inside di year wey go be public holidays or special days for Nigeria.

Dis special days na di days wey goment fit no declare holidays but pipo go still observe dem sake of say dem dey special.

Dis na some of di public holidays and some oda days dem go observe for Nigeria inside 2025.

Di important days wey goment go declare as public holidays na:

January 1

Tuesday, January 1, be New Year Day na public holiday. Di day mark di crossover from 2024 enta 2025.

March 30

Sunday March 30 and Monday 31 March fit be Eid Al-Fitr (dis date fit change sha sake of say na wen dem see di moon dey determine wen goment go declare public holiday for Id or not.

March 31

Monday March 31 fit also fit be Id el Fitr. Dat day sha na public holiday.

April 18

Easter na Christian holiday wey Christians dey use remember di crucifixion of Jesus Christ and im death on Calvary. Dis year 2025, Good Friday fall on 18 April.

April 20

Easter Sunday na 20 April.

April 21

Easter Monday fall on 21 April, dis na di second day of Easter and many kontris for di world dey do public holiday on dat day.

1 May

Thursday May 1 na Workers' Day for Nigeria and na public holiday. Di day na make workers rest and jolly abd to celebrate diasefs.

27 May

Tuesday May 27 na di day dem dey celebrate children for di kontri.

7 June

Saturday June 7, Id el Kabir fit happun on dis day, but e go depend on weda or not dem see moon dat day.

Still, Nigeria goment go declare dat day public holiday for Muslims to fit celebrate di Id.

June 8

Sunday June 8 fit also be Id el Kabir additional public holiday.

12 June

Thursday June 12 na Democracy Day celebration. Nigeria goment go declare public holiday on dat day.

5 September

Id el Maulud, na Muslim celebration wey dem dey do to mark di birth of Prophet Muhammed (di date fit change)

1 October

Independence Day fall on Tuesday October 1

24 December

Wednesday December 24 na di eve of Christmas and na Christians dey celebrate am Di day no be public holiday.

25 December

Thursday 25 December, Christians dey celebrate Christmas Day to mark di birth of Jesus Christ.

26 December

Na Boxing Day, di day na to exchange gift wit family friends and loved ones.

31 December

Dis na New Year Eve Observance.

Foto of Islamic celebration celebration

Wia dis foto come from, Getty Images