Tanko Yakasai: Kano governor Abdullahi Ganduje don sack im aide Dawisu over comments on Buhari-led APC goment

Wia dis foto come from, Tanko Yakassai/Instagram
Kano state govnor, Abdullahi Ganduje don sack im special adviser on media Salihu Tanko Yakasai wey many sabi as Dawisu.
Commissioner of information Muhammad Garba confam to BBC say dem sack Dawisu over im social media postings wey dey say dey contrary to dia APC goment.
Muhammad add say dem sack Dawisu because e fail to differentiate between personal opinion and official standpoint on public issues.

Wia dis foto come from, Twitter
Dawisu wey DSS pick on Friday after e post on social media say APC goment don fail Nigerians dey popular with young pipo from across northern Nigeria.
"Na true say Kano goment don sack Salihu Tanko Yakasai and di issue be say e fail to differentiate between personal opinion and official standpoint on public matters, dis na si problem."
For di statement wey Kano goment release dem say dem go continue to align and support president Buhari goment to succeed.
#FreeDawisu trend almost reach 30,000 for Nigeria Twitter
Nigerians on Twitter don begin dey tweet #FreeDawisu to ask DSS to release di former Special Adviser to Govnor Ganduje from dem custody.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, JJ Omojuwa/Twitter










