Nigeria vs Croatia: Only defensive Super Eagles fit stop di Blazers

Victor Moses

Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles

Wetin we call dis foto, Victor Moses don charge for #NGA vs #CRO #WorldCup open
Read am in 2 mins

Nigeria senior football team Super Eagles don finally announce say dem don ready to play dia first game on Saturday against Croatia.

Di match go shelle around 8pm Nigerian time for Kaliningrad Arena stadium.

Di team finally announce on Saturday morning say dem don ready for di game wey dem go play for evening.

Afta dia last friendly match against Czech Republic, Coach Gernot Rohr tok say dem still never ready, so now wen dem don finally ready how today match go be, na wetin Nigerians wan know.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Super Eagles Coach Gernot Rohr dey plan sumtin with Captain Mikel Obi

Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles

Wetin we call dis foto, Super Eagles Coach Gernot Rohr dey plan sumtin with Captain Mikel Obi

Meanwhile $50 thousand dollars reward dey for evri goal wey super eagles score for Saturday opener against Croatia, according to Nigeria Football Federation - Presido Amaju Pinnick

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Only very defensive Super Eagles fit stop di Blazers

'Super Eagles of Nigeria look very good (both for jersey and evritin), according to BBC sports tori pesin Adebola Adebanjo.

'But di question evrione dey asking na if dem go play good football too against team wey strong like Croatia wey follow teams pipo dey eye to go far for di world cup. Croatia get di experience and sabi players wey dey play top level, Ivan Rakitic and Luka Modric follow for some of dia players and na only very defensive Super Eagles fit stop dem.' According to we sports tori pesin.

Adebola Adebanjo
Wetin we call dis foto, Adebola Adebanjo believe say na four super eagles players fit do di magic for Nigeria,

Di Super Eagles fit use players like Victor Moses, Alex Iwobi, Ahmed Musa, and striker Odion Ighalo wey dey celebrate him birthday for dis match day to threaten di Vatreni (Di Blazers) goal post.

Adebola also think say dem need to dey organize for all corners, 'make we start with 3-5-2 formation, which mean say we need to get defensive and attacking balance'.

Tori be say Super Eagles of Nigeria na big games players and Croatia go dey hope say dis match no go be one of di days dem go spoil dia show.

Super Eagles training on Friday June 15

Wia dis foto come from, Twitter/@NGSuperEagles

Wetin we call dis foto, Super Eagles training on Friday June 15