World Cup 2018: Croatia 2 - 0 Nigeria

Nigeria senior football team Super Eagles on Saturday chop two goals goals from di Blazers of Croatia to lose dia first Group D game for Kaliningrad.
Di first goal come from Mario Mandzukic with mistake of Nigeria Etebo own goal for 32 minutes of first half while di second goal land through penalty from Luka Modric for di 71 minute inside second half.
Argentina and Iceland still dey wait di Super Eagles. Di two play 1-1 draw for di first match of di group.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Nigeria no do well for di friendlies wey dem play before di World Cup start but captain John Mikel Obi say di team go surprise pipo for Russia.

Wia dis foto come from, TWITTER/@NGSUPEREAGLES
Di Nigeria team na di youngest for di tournament and fans dey ginger say di players go do well.
Dis na di first time wey Nigeria and Croatia go jam for football competition.
If to say na by shirt, Nigeria don already cari di trophy. Dia jersey don dey trend since Nike launch am.
But time don reach make di Super Eagles follow dia jersey shine for football field.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2











