World Cup 2018: Pepper dem gang fans inside opening ceremony
World Cup 2018: Pepper dem gang fans inside opening ceremony
See how football fans ball in for Moscow paint dia face carry dia kontri flags as 2018 World Cup opening ceremony.

Wia dis foto come from, Getty Images
32 kontris from different part of di world go dig am for over 64 matches to know who go lift di ogbonge trophy for di Luzhniki Stadium on July 15.
Hundreds of thousands of fans don fall in Russia with different swag to rep dia teams and enjoy di opening ceremony.
Checkout some of di Pepper dem gang fans for Russia.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis na how dis football fan dey feel ahead of di Group A opening match between Russia and Saudi Arabia.

Wia dis foto come from, Getty Images
Na total support dis female Russian fan give her kontri.

Wia dis foto come from, Getty Images
Saudi Arabia fans too show say dey fall ground outside di Luzhniki Stadium.

Wia dis foto come from, Getty Images
Selfie time evribodi say cheese.

Wia dis foto come from, Getty Images
Slay queens dey show dia supoort.
End of Di one wey oda users dey read well well
World Cup 2018: Russia 5 - Saudi Arabia 0

Wia dis foto come from, Getty Images
Russia nack Saudi Arabia 5-0 for dia opening match for 2018 World Cup.
Yuri Gazinsky score di first goal as Saudi struggle for di match wey happen for Luzhniki Stadium for Moscow.
Dis result mean say Russia get 3 points for Group A.












