BBNaija: Erica go dey disqualified afta Laycon fight ? Dis na wetin we know about Big Brother rules

Erica apologise to her fellow housemates

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

Erica don apologise to her fellow housemates for her behaviour last night inside Big Brother Naija house.

She say she no fit blame alcohol for am. "I don dey angry and frustrated about oda things for a long time na wetin she tok".

She add say "I need to do something about dis because I no want am to happun again".

Erica wey di head of house for di week quarrel wit Laycon ontop wetin im bin tell Ebuka Obi-Uchendu di show host during di eviction show say she try to kiss am many times.

She get two strikes sake of say she break Big Brother rules and last week Biggie give her final warning for di incident wey bin happun wen Kiddwaya be head of house.

Wetin happun between Erica and Laycon

Erica and Kidd

Wia dis foto come from, BBNaija

E first appear say Erica dey vex before di Saturday party end. She first start to dey vex with Kiddwaya say e dey dance with Nengi. But Nengi clear Erica say she no dey interested in Kiddwaya.

Na di mata Kidd, Erica, Ozo and Nengi go inside go settle before di party end den she face Laycon.

She use strong words wen she dey warn Laycon say make e tell her wen she try to kiss am aside from di one time she bin high on alcohol.

Erica use words like say Laycon dey "ugly", be "mopstick", and be like "drumstick".

Erica also use words like "death".

Erica also vex with Kidd and Prince say dem no pick side for di fight.

She pour water for Prince side of di bed as di Deputy Head of House and say e no go sleep with her for di same bed.

Big Brother go disqualify Erica?

Erica apologise to her fellow housemates

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Erica already get two strikes for breaking Big Brother rules

Before di housemates enta Biggie house e give each of dem di rule book so dat dem go know wetin dem fit and fit no do for di house.

See some of di general rules for di reality television show

  • No contact with di outside world
  • No violence
  • Nomination of fellow housemates for eviction dey compulsory

Dis na wetin go happun for di case of violence in or around di house according to Big Brother

For di case of violent action dis na how Big Brother go handle am, dat one get penalty of immediate eviction from di house.

Big Brother go gatz decide whether Erica behaviour on Saturday break any of dis rules and if dem find her guilty dat go be disqualification because she already get two strikes before.

Last season Big Brother disqualify Tacha afta she pull Mercy hair and use strong language wen two of dem bin quarrel inside di house.