Erica disqualified from BBNaija: See Ngozi Nlewedim journey and big moments wit Laycon, Kiddwaya and odas inside 2020 Big Brother house

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Erica journey to win #85 million for di Big Brother Naija season 5 lockdown edition come to an end afta Biggie disqualify her say she violate di house rules for di third time on Saturday night.
Dis disqualification mean say she no go benefit anything from di Big brother Naija show and dem go even count her as participant of di show again.
See her journey for BBNaija house

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Erica wey be Ngozi Nlewedim na 26 years old actress and commercial model from London, England. She study screen acting for di Met Film School inside London.
She say she dey passionate to become big time celebrity, and dat na one of di reason why she bin contest to be housemate for di Big brother Naija show.
Friendship, relationship and fights
E no hard for Erica wen she land for di house to become friends wit almost all di housemates.
Some of di notable friendship she make na wit Tolanibaj, Laycon, Kiddwaya and Prince.

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Di moment she tell Laycon say she go just like make dem just be friends afta im declare im interest in a relationship.

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Even though she bin no plan to date anybody for di house, Erica find love interest in Kiddwaya.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
She tell her bestie for di house, Tolanibaj say. Even if Kiddwaya no dey di picture, she no dey attracted to Laycon.

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Wen things be like say e no dey clear for Laycon, he ask Erica to pick either himsef or Kiddwaya and stay wit di pesin instead of showing am signs like she dey interested in am.
Laycon tok dis one afta Erica bin try to kiss am for one Saturday night party, afta she drink alcohol.

Wia dis foto come from, Big Brother naija
Her relationship wit Kiddwaya follow come wit some fights wit housemates. One of dem na Wathoni.
Erica bin confront Wathoni about her constant comments and tactics sake of Kiddwaya. She believe say Wathoni like Kidd and e dey make her act anyhow towards am.
But Wathoni clear di air say na money she come win for BBNaija house, no be man.
Erica also enta fight wit Lucy after she make comment say "Erica na di head, Kiddwaya na di neck"
'If di head no turn, di neck no go turn', Lucy add.

Wia dis foto come from, Big brother Naija
Dis tok vex Erica sotee she confront Lucy.
Winning tasks!

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
Erica become head of house for di show two times as she win di Head of House games.
As Head of House, Erica bin get automatic immunity for di eviction show for those weeks and exclusive access to di Head of House Lounge.
Punishments wey Erica get for di house

Wia dis foto come from, Big brother Naija
Ozo and Erica na im collect di first strike of di season.
Biggie punish dem say dem dey whisper.
Den, Erica, Kiddwaya and TolaniBaj collect strike also because dem break di Head of House (HoH) lounge rules.
How her journey end for Biggie house

Wia dis foto come from, Big brother Naija
Di weekend wey start di palava, Erica vex before dia every Saturday party end. She first start to dey vex with Kiddwaya say e dey dance with Nengi. But Nengi clear Erica say she no dey interested in Kiddwaya.
Na di mata Kidd, Erica, Ozo and Nengi go inside go settle before di party end den she face Laycon.

Wia dis foto come from, Big Brother Naija
She use strong words wen she dey warn Laycon say make e tell her wen she try to kiss am aside from di one time she bin high on alcohol, afta dat she also deny her deputy head of house to sleep for lounge as she pour water for im bed.
For eviction night on di Sunday wey follow, Biggie issue Erica di third and final strike for breaking rules. ask her to comot from di BBNaija house immediately.














