Erica disqualified from BBNaija: Di housemate chop eviction from Big Brother house afta she collect third strike

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter
Big Brother don disqualify Erica afta she collect her third strike for her behaviour on Saturday night.
Erica enta trouble afta Biggie review di video of her fight wit Laycon wia she use strong language.
Biggie say Erica "deface im property, wen she pour water on top di head of house bed clearly dis kain behaviour dey unacceptable".
During di fight Erica use strong words to Laycon afta she claim say im lie say she try to kiss am many times inside di house wen Ebuka Obi-Uchendu bin ask am question.
Biggie also say she break anoda rule wen she no allow di deputy head of house Prince to sleep for di head of house lounge.
How Big Brother disqualify Erica

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic
Biggie tell Erica say she for tok wetin she want tok and waka comot without worsening di situation.
Im find her guilty for denying di Deputy HoH access to di HoH Lounge, peeping through di windows and calling out di camera crew, disrespecting her fellow Housemates, bullying, provocation and goading.
End of Di one wey oda users dey read well well
Biggie add say Erica actions last night disrespect Big Brother House rules and wetin make am worse na di fact say she be di current HoH wey suppose to lead by example.
Afta she collect strong and final warning from Biggie last week and in accordance with article 18 of Big Brother rule book and di three strike rule, dis na her third and final strike.
Biggie disqualify Erica immediately from Big Brother House.
Neo get strong and final warning

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic
Biggie tell Neo say im and Vee fight dey out of line.
Im give Neo strong and final warning say him obstruct and restrain im fellow housemate wit force, and deny her freedom within di Big Brother House.
Vee too no dey innocent Biggie tell her say grabbing of Neo shirt for put her for trouble".
Biggie tell di Housemates say im no go tolerate dat kain attitude for Big Brother House.
E warn dem make dem dey very careful from now on, on di kain words dem go use.
Wetin happun between Erica and Laycon

Wia dis foto come from, BBNaija
E first appear say Erica dey vex before di Saturday party end. She first start to dey vex with Kiddwaya say e dey dance with Nengi. But Nengi clear Erica say she no dey interested in Kiddwaya.
Na di mata Kidd, Erica, Ozo and Nengi go inside go settle before di party end den she face Laycon.
She use strong words wen she dey warn Laycon say make e tell her wen she try to kiss am aside from di one time she bin high on alcohol.
Erica use words like say Laycon dey "ugly", be "mopstick", and be like "drumstick".
Erica also use words like "death".
Erica also vex with Kidd and Prince say dem no pick side for di fight.
She pour water for Prince side of di bed as di Deputy Head of House and say e no go sleep with her for di same bed.
How social media react to Erica disqualification

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter
Na Erica tori full for socia media as fans of di show dey react to her disqualification inside Big Brother house.
See some of dia tweets here:
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4