BBNaija strikes: Erica, Kiddwaya, Ozo and Tolanibaj collect warning from Big Brother - See di reason why

Pic of Kidwayya, Erica and TBaj

Wia dis foto come from, Big Brother Naija

Read am in 1 mins

Big Brother punish four housemates inside di lockdown season 5 house today.

Di housemates na Erica, Kiddwaya, Ozo and TolaniBaj.

Biggie give dem strike on eviction Sunday and di day im return back to di house afta one week of absence.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wetin di housemates do?

Ozo and Erica na im collect di first strike of di season.

Biggie punish dem say dem dey whisper.

Den, Erica, Kiddwaya and TolaniBaj collect strike also because dem break di Head of House (HoH) lounge rules.

Erica sake of say she spend di night for di HOH lounge, while TolaniBaj spend di night for Prince bed.

As e be so, Erica don get two strikes. If she collect anoda one, Na bye-bye to her be dat.

Wetin Biggie rule tok?

According to Biggie rule, housemates no suppose communicate without cameras/microphones recording the communication (e.g. to dey tamper with microphones, writing secret messages, to dey whisper or move mouth without talking.) or if dem try to tamper with or cover recording equipment or if housemates communicate for secret code - Big Brother get di right to issue a strike or disqualify di Housemate."

Also, housemates no suppose sleep for di HoH lounge except di HoH and im deputy.

Punishment for di whole HouseFor dia bad behaviour in di House, Biggie also punish di rest of di Housemates. Di housemates no go get hot water for di bathrooms for di next few days.

Biggie add say dia attitude go determine how long dis punishment go last. Henceforth, dem no dey permit to use di pots, pans or kettles to boil water wey dem use di bathrooms.