Lisa Hanna: Meet di Jamaican 'presidential candidate' wey her video dey make pipo tok

Wia dis foto come from, Lisa Hanna
Two weeks ago many Nigerians no sabi who Lisa Hanna but dis change afta one video begin circulate for social media wey show di woman as 'Jamaican Presidential Candidate'.
Well we get di real gist behind di woman - and who she really be. But we fit tell you now for free: she no be presidential candidate.
E no dey clear why dem refer to her as di 'Presidential candidate' for di video posts wey pipo share for dia timeline, but di 'promotional' video torchlight madam Lisa work for di constituency wey she dey represent as member of Jamaica parliament.
Di 1:18 secs video ontop Twitter don already get 1.7 million views and ova eighty thousands likes.

Wia dis foto come from, Instagram/lisahannamp
Who be Lisa Hanna and wetin di video dey about?
Di video of Lisa wey go viral na her campaign video to seek re-election as member of Parliament no be say she dey run for di office of di president of Jamaica.
Di 45 year old mama of one, na di third Jamaican woman to become Miss World for 1993.
Lisa Hanna na member of di opposition People's National Party for Jamaica, and she dey currently serve as Member of Parliament for Saint Ann South East.

Wia dis foto come from, Instagram/Lisahannamp
For 2007 general elections, Hanna contest and win di seat for to represent her constituency for di Jamaican Parliament and dis election make her one of di youngest woman to become MP for di kontri.
End of Di one wey oda users dey read well well
Since 2007, Lisa don serve as MP three times and she still dey contest di fourth term for office.
As she dey serve as MP, Lisa also serve as Minister of Youth and Culture from 2012 to 2016.
How social media react?

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot

Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
'Fashion icon'
Lisa na fashion icon wey don face plenti bad mouth from pipo wey feel say as a politician she suppose get some fashion morals, sotey she write article wey she title 'The Legislative Dilemma'.
If Lisa Hanna win her re-election to di Jamaican House of Parliament, e go be di fourth time for her to serve as MP for di kontri since 2007.

Wia dis foto come from, Instagram/lisahannamp

Wia dis foto come from, Instagram/lisahannamp













