Ed Sheeran and Cherry Seaborn announce birth of dia daughter Lyra Antarctica – See oda celebs wey become parents dis coronavirus period

How pipo take announce dia pikin

Wia dis foto come from, Instagram

Read am in 2 mins

Ed Sheeran don announce today say im don get bouncing baby girl with im wife Chelsea Seaborn.

E announce dis one for im social media handle on Tuesday say na one week ago dem born im pikin, Lyra Antartica Seaborn Sheeran.

E come add say di mama and pikin dey do well.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Dis year, despite di coronavirus palava, many celebrities announce di birth of dia pikin dem.

See some of dem.

Simi & Adekunle Gold

Simi and her pikin, Adejare

Wia dis foto come from, Instagram/@symplysimi

Wetin we call dis foto, Simi and her pikin, Adejare

Nigerian singer, Simi welcome her daughter, Adejare with husband Adekunle Gold wey dem born for 30 May.

D couple wey bin do secret wedding last year first share di news say dem dey expect addition to dia family wen Simi drop "Duduke" wey shake di music world for May.

Regina Daniels & Ned Nwoko

Regina Daniels and her pikin

Wia dis foto come from, Instagram/@regina.daniels

Na for June dis year Nigerian actress, Regina Daniels announce di birth of her first pikin, bouncing baby boy, Munir Neji Ned Nwoko, with husband Ned Nwoko.

She bin reveal say she get belle for May with photoshoot for inside social media.

Katy Perry & Orlando Bloom

Katy Perry and Orlando Bloom

Wia dis foto come from, Getty Images

American singer, Katy Perry give birth to her first pikin, baby girl at di age of 35 wey she name Daisy Dove Bloom.

Na her bobo, actor Orlando Bloom bin announce dis one for im social media on 27 August say dem dey lucky to give birth for peace even for dis coronavirus time.

Joe Jonas and Sophie Turner

Joe Jonas and Sophie Turner

Wia dis foto come from, Getty Images

American musician, Joe Jonas and Sophie Turner welcome dia first pikin, a bouncing baby girl wey dem name Willa Jonas for July, 2020.

Di two wey bin marry for June last year for lavish event for Paris, bin no really tok so much about dia pregnancy.

Even as na only on statement dey give tori pipo on di state of dia pikin.