Adekunle Gold and Simi pikin Adejare dey America dey bond as 'AG Baby Something Different' new album go soon drop

Adekunle Gold and Simi
Wetin we call dis foto, Adekunle Gold and DJ Edu of BBC Radio 1Xtra
Read am in 2 mins

Nigerian artist Adekunle Gold na new papa wey don dey gel wit im wife Simi any chance dem get to arrange tins for dia new pikin togeda.

Adekunle wey come from Nigerian royal family dey married to Simi wey hersef na successful musician.

DJ Edu of BBC Radio 1Xtra jam di couple for Houston, Texas, to congratulate dem on di birth of dia first pikin.

Simi and Adekunle Gold

Wia dis foto come from, Simi/Twitter

Wetin we call dis foto, Simi and Adekunle Gold

So, DJ Edu ask dem if dem don do like Prince Harry and Megan and decide to comot Nigeria?

"No! We come here before di lockdown and na so we come hook since dat time. But hey, everitin dey cool. Anytin you buy here for America na you go take your hand fix am by yoursef - na DIY kontri. No oda way to bond wit your partner beta pass di one, wey we go dey fix small-small tins.

"She go read wetin dem write for di manual and I go dey screw am. Na lovely time for di two of us," di Afrobeats singer tok.

Skip YouTube post, 1
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 1

So how fatherhood be?

"I dey enjoy every part of am. I dey always compose songs just to make am stop her cry-cry. When she begin do one kain and you start to sing or you play music to her she go stop. E be like say she like am," im tok.

Adekunle Gold also dey in di process to born new album. Before na Highlife music im be face and na wetin most of im music dey on, but anoda direction fit dey dis time if pesin consider di name of di new record - Afro Pop.

"Like two years ago my ear begin grow, I begin listen to different-different type of music - Caribbean artists, pop artists… [I come see say] I bin dey limit myself for my melody. Dis one no mean say wetin I do before no good oh, e just be say I wan do something different."

Skip YouTube post, 2
Allow Google YouTube content?

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of YouTube post, 2

And like say im plan am, 'Something Different' na di name of di first song wey Adekunle Gold drop from di album.

Simi song 'Duduke' wey she sing for her pikin when she still dey pregnant, don already become hit.

Di full interview wit Adekunle Gold go air on This Is Africa programme on Saturday 25 July, on BBC World Service radio, and ontop partner stations across Africa.

Broadcast time na 10:32pm.