Herman Cain die with Covid-19: How di US ex-presidential candidate rise to become ogbonge politician and businessman

Republican presidential hopeful Herman Cain speaks at a conference in 2011

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Herman Cain run for president for US for 2012

Herman Cain, di Republican pizza chain CEO wey run for president for 2012, die afta im catch Covid-19.

Dem bin admit Oga Cain, wey be 74 years for hospital wit di disease early dis month.

"Herman Cain- our oga, our friend, father to so many of us - don die," na di message wey dem post for im official website tok.

For 2006, Oga Cain, survive from late stage of colon cancer, im be one of di popular US victims of Covid-19.

Im social media accounts bin dey give regular updates on im condition. For 7 July, one post from im Twitter account say "doctors dey try to make sure im oxygen levels dey right".

"Dis na tough virus," na wetin di post tok "please continue to pray."

Oga Cain bin appear without mask for one rally wey President Trump do for Tulsa, Oklahoma, for June 20.

Dem admit am for hospital with coronavirus for July 1, although e no dey clear when or wia im catch di infection.

Di president pay tribute to oga Cain on Thursday for di White House, e say: "im be very special pesin... and unfortunately im die from one thing China virus."

Mitt Romney and Herman Cain

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Mitt Romney and Herman Cain both stand as Republican candidates

Who be Herman Cain?

Dem born am for Tennessee and im papa work as janitor, chauffeur and barber, and im mama work as servant, Oga Cain get degree for maths and masters for computing.

Im work as a Baptist minister, radio talk show host and as a businessman.

Oga Cain na pesin wey bin dey ginger for flat tax system- im 9-9-9 plan - and im run for office afta im tenure as CEO of Godfather's Pizza.

Wen im din dey run for office, im tell reporter say im no dey for "anyhow questions".

"And when dem ask me who be di president of Ubeki-beki-beki-beki-stan-stan, I go say you know, I no know. You sabi am? "

Im bin dey popular for di beginning but later im come find imself inside plenty sexual harassment allegations.

Although im bin deny di accuse dem, im popularity suffer and im later suspend im campaign. Mitt Romney later come become di Republican candidate for di unsuccessful race against President Barack Obama bid for a second term for office.

For 2019, Trump bin want make im siddon for di Federal Reserve Board, but im withdraw im nomination afta several Republican senators no gree support im appointment.

Mitt Romney dey among pipo wey pay tribute to oga Cain.

"I dey feel sad say Herman Cain - ogbonge man for business, politics and policy - lose im battle with Covid," na wetin im write for Twitter.