Trump don cancel meeting with North Korea

Read am in 1 mins

US President Donald Trump don cancel meeting im suppose do wit North Korea leader Kim Jong-un.

Im say di decision dey based on di "vex mind and anger" wey dey for one recent North Korean statement.

President Trump say e no go make sense to hold di meeting wey dem suppose do for Singapore on 12 June.

For letter im write to Kim, im say im dey look forward to see am "one day".