Bola Tinubu profile: Nigeria APC presidential candidate
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Bola Tinubu wields enormous power in western Nigeria politicsArticle Information
Author, Nduka Orjinmo
Role, BBC News, Abuja
Bola Tinubu, 70, dey widely known as di pesin wey reshape Nigeria commercial capital, Lagos.
Na im go lead di ruling All Progressives Congress (APC) go February presidential election but e dey face very gingered opposition, allegations of corruption and health wahala as e dey face one of di hardest job for Africa.
As pesin wey don face exile sake of military ruler Sani Abacha, oga Tinubu know di value of freedom and e dey wia am as sign for im cap, broken chain wey look like sideways figure eight.
As a trained accountant, na im waka wit di pro-democracy National Democratic Coalition (Nadeco) group wia im be member make am cross Abacha.
Di opposition of groups like Nadeco and Abacha death for 1998 na im carry Nigeria to democracy for 1999 and in many ways, oga Tinubu wey be former Mobil executive see Nigeria presidency as im right.
E go dey depend on im experience for politics and im ogbonge influence for di kontri to win election. E dey face strong competition from former Vice-President Atiku Abubakar for di People's Democratic Party (PDP) and Labour Party, Peter Obi wey dey popular with city voters.
If oga Tinubu aka "Jagaban" win di presidency, im go dey look to unify kontri wey regional lines don scata, tackle insecurity, create jobs abd bring down inflation.
But dat job no shake am. E dey point to im time as Lagos govnor from 1999 to 2007 to sell im candidacy give party delegates and to Nigerians.
Under im tenure, Lagos grow im income wella sake of plenti foreign investment, as im public transport scheme wey see dem build new lanes for rapid bus to reduce di ogbonge traffic wey pipo dey face.
Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin we call dis foto, Despite im ogbonge wealth, Lagos able to solve never dey able to solve no di ogbonge traffic jams by completing a light rail project wey Mr Tinubu bin start.
But di city wey get about 25 million pipo neva really live up to im megacity name even though e claim say im turn tins around.
Public infrastructure mostly don spoil finish, tins like water and public housing don breakdown, as di light rail project wey start for im tenure neva finish 20 years later even with all di money of di state..
E also dey accused say e dey hold di neck of di state money even afta e comot govnorship for 2007.
Everi govnor wey don come afta am na im follower wey dey follow "grand roadmap", as di one wey dare find im path bin dey quickly rerouted with help from powerful transport union members.
Two years ago, Dapo Apara, accountant for Alpha-beta, company wey Tinubu allegedly get stake for, accuse am say e use di company do money laundering, fraud, tax evasion and oda corrupt tins.
Oga Tinubu sue am even though im and Alpha-beta deny di accuse but later, all parties say dem go settle out of court.
Dat accuse, including say im face Nigeria Code of Conduct Tribunal (CCT) twice for accuse of breaching public officers code (wey dem don clear am of) make opponents of Tinubu to say e no be di right man for di job as corruption dey high for Nigeria.
Who dey di race to run tins for Nigeria?
Learn more about Nigeria presidential candidates
Choose a candidate to view dia bio
Bola Tinubu
All Progressives Congress (APC)
Age: 70.
Im study accounting for Chicago State University.
Two-term Lagos State Governor from 1999-2007.
Im represent Lagos West for Senate from 1992 to 1993.
Na veteran of Nigerian politics, dis na im first presidential bid.
Campaigning against military rule.
Im grow Lagos State annual revenue by more than four times from N22.2 billion for 1999 to N220.9 billion for 2007.
E work as senior auditor and later treasurer of Mobil Producing Nigeria, one of di kontri largest oil producers.
Im plan to boost Nigeria export and reduce reliance on imports.
Im plan to cut youth unemployment rate in half within four years and create one million jobs for ICT in two years.
Reform di justice system to focus on crime prevention and improve trust in security forces.
Atiku Abubakar
Peoples Democratic Party (PDP)
Age: 76.
Vice President of Nigeria from 1999 – 2007.
Im get Master's in international relations from Anglia Ruskin University, UK.
Im be former customs officer wey come into politics for early 1980s.
Five unsuccessful presidential bids in 1993, 2007, 2011, 2015 and 2019.
Im found di American University of Nigeria, wey offer scholarship to freed Chibok girls.
Na successful businessman with investments in oil services, agriculture, banking and pharmaceutical sectors.
Controversial privatisation of goment assets agenda.
Im plan to give private sector greater role in di economy.
Reinforce national unity through equity, social justice amongst Nigeria diverse pipo.
Im plan to restructure Nigeria governance system.
Peter Obi
Labour Party (LP)
Age: 60.
Two-term Governor of Anambra State from 2007 to 2014.
Na Presidential running mate during di 2019 election.
A business man, im study philosophy for University of Nigeria, Nsukka.
Im establish sub-sovereign wealth fund wey worth about $156million in dollar-denominated bonds by di end of im tenure as governor.
Im move Anambra from 26th to 1st in di ranking of best performing states for NECO and WAEC national examinations.
E own chain of retail business wey don create thousands of jobs.
Im plan to ensure accountability in governance and fight corruption.
Im plan to move Nigeria from consumption to production.
Prioritize Human Capital Development through robust investments for STEM education, health, and infrastructural development.
Rabiu Kwankwaso
New Nigeria Peoples Party (NNPP)
Age: 66.
Minister of Defence from 2003 to 2007.
Kano State Governor from 1999 to 2003, and 2011 to 2015.
Im represent Madobi Federal Constituency for House of Representatives for 1992 and Kano Central Senatorial District between 2015 and 2019.
Im get PhD in civil engineering from Sharda University, India.
Scholarship and philanthropic efforts.
Im increase di primary school enrolment figures from one million in 2011 to over three million in 2015 wen e leave office.
E introduce free school feeding and uniforms for primary school pupils.
Im establish Kano University of Science and Technology in Wudil and di Northwest University, wey be Kano first and second state universities.
Im plan to create jobs through investment in agriculture.
For di last election, bullion vans wey banks dey use move money, drive enta im Ikoyi compound for Lagos wey ginger suspicion say im dey buy votes, and e no try hard to deny am.
E say, "if I get money, if I like I go dash pipo, as long as I no dey buy votes".
Many pipo also neva forget wetin im tok afta di death of #EndSARS protesters for di Lekki part of Lagos for 2020 wia im question di intentions of di pipo wey die.
Dem see am as di political godfather of di south west and na di region most influential figure wey dey decide who go get power.
For 2015, e call imself say e be "talent hunter" wey dey put "talents for office".
Wia dis foto come from, AFP
Wetin we call dis foto, Mr Tinubu (L) claim say e help both Vice-President Yemi Osinbajo (C) and President Buhari (R) enta office
Im political influence na im lead to di merging of opposition political parties for 2013 wey collect power from di den ruling PDP for 2015 wey dey rare for Nigeria.
E bin remind Nigerians say na im be one of di main pipo wey put President Muhammadu Buhari for power afta plenti failed attempts.
Oga Buhari pipo bin don try to reduce di narrative of di influence of di former govnor for di 2015 election, but e no clear say Buhari for win im two terms without Tinubu backing.
E dey widely rumoured say na im nominate Vice-President Yemi Osinbajo for im role and get hand for how Nigeria Senate President Ahmed Lawan and di Speaker of di House of Representatives, Femi Gbajabiamila get work.
Na why im supporters bin take am as betrayal wen di vice president wey bin work as commissioner with Tinubu for Lagos run for di party ticket.
All dat now dey behind am and as Tinubu dey campaign, many pipo dey look im health and physical appearance as e bin spend three months for London on top knee injury and worry about one undisclosed sickness.
Nigerians fit dey fear anoda president wey get health issues afta President Umaru Yar'Adua die for office for 2010 and Buhari wey go abroad wella for medical treatment.
Sha, who ever win February election wey still dey look like e go tight, go get plenti mata wey Buhari leave to deal with - insecurity, high unemployment, rising inflation and ethnic division.
No be say di work no possible to do, but e go hard sha.
Wetin we call dis Video, "I dey different, I be Bola Ahmed Tinubu"